ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Rain nearly put me for wahala, Tori Olorun!

News Express |17th May 2022 | 486
Rain nearly put me for wahala, Tori Olorun!



Lagos na one kind place. Anybody wey no get sense for Lagos, forget am, train don lef am be dat.

No wonder people dey call Lagos Eko Akete, Ilu Agbon.

Na im make anybody wey jus start taxi driver work for Lagos dey always land for troublem – if dem no hit di nyash of your car, you go jam bridge or you go carry sisi passenger wey fit put you for wahala.

But we wey our head don strong for dis work, noting fit shake us. We don become ogbologbo. If no be so, my broda, di son of man for don peme tey tey for sisi dem hand.

See like di order Sunday wey rain fall for morning like say e no go see fall anoder day.

Una remember say before den, heat nearly finish people and na so krokro take over everybody skin.

Dat Sunday, as my wife Bose dey prepare to go church with our two woman pikin dem – Bisi and Funke – me I dey prepare to go our garage wey dey near Ikeja under bridge.

I wait make dem go finish before I jump inside my guonguoro.

I no reach dat our Abule Egba junction wen every wia come dark patapata. Small time rain don start be dat. And no be small rain o.

As I wan corner dat junction, one sisi stop me, e say e dey go Ikeja. I carry am as e be my route.

Rain don soak sisi from head to toe and na one kind light clothe e wear. Everyting wey dey for under come show as rain soak am.

Wen we reach Oba Akran Avenue for Ikeja, my guonguoro quench. Water don enter caburator be dat. Na so me and di sisi jus siddon inside as water don turn di road to river.

We jus dey look our sef ti ti ti like say we drink one drum of lookozade.

Small time di sisi come dey shake. E say cold dey catch am. E begin shift dey come driver seat wey I siddon. Na im I come talk am for my mind say man pikin don enter wahala for dis rain.

Di sisi take im head put for my leg. E say make I cover am well well. I tell am say I no hold wrapper. E say make I remove my jumper and shokoto trouser take cover am.

Quick, quick, e don begin comot my shokoto rope, bring out my kini to put for im mouth. So dis sisi wan rape me be dat? Tori Olorun!

Dat very time, I hear knock for my window glass pom, pom, pom. I look, na agbero dem wey dey take rain make money – if your motor quench for water, dem go push am como and collect money. If sisi no fit cross water, dem go carry am for back, collect money.

My sisi passenger say make I no mind di agbero dem, make we dey inside my guonguoro till di rain stop.

Na im I take style signal di agbero make dem push my guonguoro comot for di water.

Come see contour for dis sisi face dat time. To say e hold gun, e for finish all dose agbero wey spoil im plan.

Na so I go drop di sisi for inside General Hospital wey e dey go.

E vex comot money for hand bag pay me, open door and go down.

Come see as e hit my guonguoro door like say im and di door dey fight. Olorun Oba o!

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog.

Comments

Post Comment

Friday, June 20, 2025 1:43 PM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025