Di ting wey my okada broda dem dey take dia eye see for Lagos road everyday no be small ting o.
Now wey okada don full ground, na so dead body too full ground. Dat time na only Calabar dem dey show us for TV say dem take okada do township taxi. For dia, dem say okada na Alalork or How far? But now, I no know which one plenty pass – okada or church?
E be like say di two both of dem dey do national compete. If you go Benin, na okada. For Aba nko? Na okada. Take style reach Kano, you go know say okada even get head office for dia.
Lagos and Ibadan sef no wan gree at all at all. For Port Harcourt I hear say dem dey take okada escort dia governor sef. True, okada sickness don catch di hole country.
Okada people get union wey strong well well. I no know wetin dem dey wait for before dem make Bubu dia grand patron. Who no know say okada na Bubu grand pikin?
See all di okada for Lagos, who dey drive am? No be aboki dem?
No be say okada no good. Di only ting be say, okada sickness too plenty – if e no trowey person scater im head for express way, amu robber go use am thief sisi dem hand bag for road or gbomo gbomo people sef fit do like passenger, den take style carry di okada man go inside forest, go hand am over to kidnapper or bandit or terrorist
Di order day I see anoder ting wey okada cause. Na for Alagbado e happen upon say Oga Sanwo-Olu don stop okada for major road dem for Lagos.
I carry passenger dat morning for Abule Egba. Di bobo say make I drop am for Iju. Na im I say make I take dat Agbado road go burst out for Ishaga, den branch left go Iju.
As we dey go, na im I see plenty people tanda for bus-stop. No chance for motor to drive pass sef. One bobo wey wear black glass for eye jus dey hala with one okada man. Di bobo talk oyibo sote oyibo finish for im mouth. Aboki no evev understand di oyibo wey di bobo dey talk.
As chance no dey to drive pass, I clear my guonguoro, with my passenger inside. I go ask dem wetin happen. My broda wen dem tell me, na so I begin laugh sote people tink say I don kolo. Imagine!
Di bobo been wan rush go meet im new sisi wey live near dat bus stop. E no wan waste time for bus, so e take okada. E even promise to pay di okada man double money if e fit give am express service to di sisi house.
But di okada man no fit move as di bobo want am. Quick, quick, di okada passenger take over from di okada driver.
As dem reach for di sisi place, di okada man say make di bobo pay im money. Na im di bobo ask am weda na who go pay who. E say im even expect di okada man to pay am as e helep am do im work. Fight don shele be dat. Abami Eda go say Overtake Don Overtake Overtake (ODOO). Anoder okada sickness!
I no blame di bobo sha. Who no go rush if im new catch give am time to come do di ting? If you do African Time and di sisi close im door, you know di year e go open am again?
Make we jam again on Saturday.
Tank you.
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
•Credit: Matilda's Blog.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.