Updating your news feed...

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

























Loading banners
Loading banners...


Ogbonge Naija strika Victor Osimhen
By NELSON DAFE
Di wey some Ghana fans dey dred ogbonge Naija strika Victor Osimhen ehn as di match bitween Naija Supa Eagles and Ghana don near,no be smoll. Dem.dey call Osimhen beest ‘wons e dey front of goal’.
Na on Friday nite for Baba Yara Sports Stadium for Kumasi na e Ghana go host Naija for di fest leg of di Qatar 2022 world cup kwolifaya.
Ghana futbol tori pipul on Tuesday mention Osimhen with Odion Ighalo and Sadiq Umar say na dem be di Nigeria strika dem wen dey score gol for dia difrent club dis sizin.
Some Ghana fans yan with tori pipul and come dey yan as dem see di match.
One Ghana man wey dem dey call Sylvester say: “For me, di Nigeria playa wey I dey fear pass no pass Osimhen. Na beest im be for front of goal o.”
“Di guy get everitin wey top strika need. Di way e take dey fite to win di ball and di way e dey score goal ehn, no be smol.”
“Na Osimhen I fear pass for Supa Eagle. Pipul dey tok about Odion Ighalo but I bo dey fear am becos e don old. Forget say e don score many goals for Saudi Arabia, dat one na smol leeg. Di ida Nigeria stika dem wey I dey dred na Sadiq Umar wey dey Almeria and Emmanuel Denis wey dey Watford.”
Another Ghana fan Duncan Adjoa come still mention Osimhen. E say: “I dey shame to tok am but Ghana no get strika like Osimhen.
“To me dat Friday match go end 1-1 dro becos I no reeli no who wan score gol for Ghanabut Nigeria fit bost say dem get great nomba 9 like Osimhen.”
On Saturday Osimhen make histri for Italy leeg. E score 2 gols for Napoli wey dem win Udinese 2-1 afta e don score di same 2 gols for di match before dat one wey Napoli play.against Hellas Verona.
Dis wan tu come make Osimhen di fest Naija boy wey don score more dan 10 gols for 2 strait sizin naw for Napoli for Italy Seria A.
Olredi Osimhen don do more dan e do last sizin for Napoli.