If you Ebele me, I Bianca you

News Express |22nd Mar 2022 | 568
If you Ebele me, I Bianca you

I no sabi before say blood and Coke dey compete for market. Wen I dey hear tele tele say some people dey sell dia own blood, I dey tink say dose people don craze. True, I no know say after white powder, na blood dey follow am for market.

If you reach hospital see di number of bobo dem wey line up to sell dia blood every day, afraid must to catch you. I swear!

Na di ting wey happen di order day wey make me see dis America-wonder.

Dat Saturday, I say make I rest small for house before I carry my guonguoro enter road.

No be everyday man pikin go dey for road 24/7, and body no be wood..

Me, Bose and Funke dey for palour dey watch one program like dat for TV. Small time, I notice say Bisi no dey dia. Bisi wey be say if you put food and film say make e take one, e go take leg match di food den carry di film go.

I use style go outside, I no see am. I go kitchen, e no dey dia. As I say make I turn di order side take style go check toilet, na im I jus dey hear Hmm! Hmm! Hmm! like dog wey wan born pikin.

I follow di noise go, come see Bisi dey vomit for backyard. I come begin shout for im head say Eledumare don catch am today, say e don go chop di one wey big pass am. I say if e no tell me di person wey do am, I go take matchet commot im head today today.

Bisi dey say abeg Daddy, Daddy abeg. I tell am say, make e put im mouth for shut up kia kia. I tell am say if im name don turn to Ebele, me sef go Bianca am now, now, now! Shioorr!

I tell Bisi say, di only ting wey I wan hear for im mouth now na make e tell me who do di ting.

Bisi come waste time. Instead, e still dey tell me Daddy abeg, Daddy abeg.

Na so I give am for face ppossaarrhh! Bisi jus fall down for ground. I wan move inside house go bring my matchet, na im person hold me. Everybody for our compound come dey beg me.

Una kukuma trust all dis face-me-I-face-you house, say small ting happen like dis, everybody don come out.

Di next ting be say, I carry Bisi put for inside my guonguoro, begin dey go General Hospital for Ikeja.

Quick, quick, dem carry am go inside. Dem say make I wait for corridor. Small time doctor come out, squeeze im face, shake im head, den begin look me for face. I nearly piss for my shokoto trouser. Wetin happen to my pikin? Na so my body come dey shake like Shakespear. Tori Olorun!

Small time di doctor come tell me say na food poison dey worry my pikin and e go need blood. I ask am for wia I go see di blood. Di doctor say if I don ready make I enter make dem take my blood, since na me be di Papa. I say no troublem.

I tink say na for di small chechere tube wey dem dey take blood sample o. But wen di doctor say na di size of pure water bag dem wan, my broda, I come calm down like say dem pour me ice water. Olorun Oba o!

Before I turn my face sef, 10 hefty bobo dem don appear. Dem say if na blood I wan, dem ready to donate, even if na one drum I wan.

I look dem ti-ti-ti-ti. Some be like people wey never see food chop since last year. I come talk am for my mind say no be my pikin una go give dat kind una blood. One bobo sef resemble amu robber. I say anybody wey dat kind blood enter im body, go jus become kidnapper or bandit one time.

Small time, di doctor come out, e say weda I don ready with my blood. Doctor say if I no do quick, any ting fit happen to my pikin.

Quick, quick, I carry one of di hefty bobo go one corner and talk.

But I tank Eledumare say di money wey I pay for di blood no loss. My pikin don well and im body strong kakaraka.

Make we jam again on Wednesday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.

•Source: Matilda”s Blog

Comments

Post Comment

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

 ‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

On Sept. 10, Oracle’s stock price surged by more than a third at market open, pushing Ellison past Musk. However, the Tesla CEO regained the top spot by the end of the day, with Bloomberg valuing Musk at $384.2 billion and Ellison at $383.2 billion.

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

The tiny South African town the United States wants to control

The tiny South African town the United States wants to control

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

Would-be Trump assassin tries to stab himself in neck after guilty verdict

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

History as Enugu begins transition to Smart Green Schools

History as Enugu begins transition to Smart Green Schools

Wednesday, September 24, 2025 10:25 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025