Me sef wan go meet Baba for London

News Express |18th Mar 2022 | 655
Me sef wan go meet Baba for London

Dis life no be as people tink am. Na only Eledumare sabi everyting for dis world.

You fit tink say person own don finish, but you go surprise say tomorrow na im everybody go dey call “Oga mi sir”. Olopa sef go dey tanda for attention and salute am say “Tion sir, all corrupt sir!”

Up till yesterday yesterday morning, any passenger wey I carry, go dey talk say Chairman own don finish. I dey tink say who be dis Chairman wey everybody jus dey talk about?

One madam wey I carry for drop go Ojodu Berger own na im make me begin laugh. Di madam curse Chairman tire. Tori Olorun!

As e enter my guonguoro for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na im di madam begin dey curse Chairman.

E say na God catch dat yeye Chairman. E say na im be Woman Leader for im Ward for di same party wey Chairman dey . But any time wey e go to meet Chairman for Abuja make e give am small contract, Chairman no go gree see am.

E say di last time, e siddon for Abuja for one week make e see Chairman. But every day, Chairman go say make im PA tell am say Chairman dey for meeting.

Di madam say if no be say e do small part time ashawo for Abuja, e no for see transport money take come back Lagos.

Till I drop am for Ojodu Berger, di madam jus dey pour curse for Chairman head. E say e go do tanksgiving for church on Sunday becos say dem don sack di yeye Chairman wey make am go dey do part time ashawo for Abuja make e get transport money come back Lagos.

Anoder passenger wey I carry for drop go Maza Maza yesterday afternoon come dey happy well well. I hear am wen e call somebody for phone dey tell am say all di people wey plot coup for Chairman don fail. I come dey tink weda na di same Chairman wey dat madam dey curse for morning dis bobo dey talk about.

Di bobo come dey tell im friend for phone say all di enemy of Chairman don shame. E say wen wahala too much, na im Chairman run go meet Baba for London.

E say na for London Chairman and Baba finish di matter. E say Baba tell Chairman say make e no mind all dose yeye people, make e jus go back and do im Chairman work. Olorun Oba o!

Di bobo even tell im friend for phone say no be only Chairman carry im matter go meet Baba for London o. Di bobo begin mention dia name one by one.

I say shiooorr! Who be dis Baba for London sef? Shey na Babalawo abi na Baba Aladura? Di bobo jus dey say Baba, Baba, Baba, na who be dis Baba?

Well, if na to go meet Baba for London all matter go settle, na im be say me sef go carry all my wahala go meet dat Baba for London. Abi how una see am?

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

•Credit: Matilda’s Blog

Comments

Post Comment

Nearly 2 million evacuated as deadly Typhoon Ragasa slams into southern China, after killing at least 17 in Taiwan

Nearly 2 million evacuated as deadly Typhoon Ragasa slams into southern China, after killing at least 17 in Taiwan

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

 ‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

On Sept. 10, Oracle’s stock price surged by more than a third at market open, pushing Ellison past Musk. However, the Tesla CEO regained the top spot by the end of the day, with Bloomberg valuing Musk at $384.2 billion and Ellison at $383.2 billion.

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

The tiny South African town the United States wants to control

The tiny South African town the United States wants to control

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

Would-be Trump assassin tries to stab himself in neck after guilty verdict

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

Wednesday, September 24, 2025 10:30 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025