I wan go carry our pikin dem for Ukraine

News Express |1st Mar 2022 | 835
I wan go carry our pikin dem for Ukraine

Dis oyibo Russia and Ukraine wahala wey I dey hear upandan so dey turn my belle. I swear!

No be becos say di two both of dem dey fight o. Wetin concern me. But na wetin dey happen to our Naija people wey dey dia, especially our pikin dem wey dey go school for dia, na im concern me.

I hear say all order contry for dis world don carry dia people comot for Ukraine, na only Naija people remain. Haba!

I no even know wetin dey happen until yesterday wen I carry two bobo like dat for drop go Dopemu.

Since di time dis two bobo enter my guonguoro, na so so oyibo Russia and Ukraine fight tori dem dey nack.

Small time dem come use dia phone dey play di video wey Naija school pikin dem dey cry,, dey talk.

Dem put di school pikin dem inside one room since morning, no food, no water. Dem say Naija embassy Oga tell dem make dem dey wait for bus wey go come carry dem cross Ukraine border, enter Poland. And na so dem don dey wait ti-ti-ti, dey look road, di danfo, abi na molue, no show face. Tori Olorun!

Wen I drop di two bobo dem for di place dem go for Dopemu, I beg dem make dem show me dat video wey dem watch inside my guonguoro.

Na so I begin cry wen I look di video finish. Why Naija gofmen go make our own pikin dem suffer like dis? Olorun Oba o!

As I dey drive dey go back, I come talk am for my mind say, if na ordinary to carry di school pikin dem cross border for gofmen bus, and di bus no gree show face, ehn, my guonguoro dey nau.

Everybody sabi say no place wey my guonguoro no fit enter. Di only ting na to service am well well and buy enough petrol wey go last me till I reach for Ukraine. By di time I carry di school pikin dem 10 batch, di matter don settle be dat.

But my only troublem now na di petrol wey no dey town. How we go come do am?

Well sha, if una come our garage wey dey near Ikeja under bridge and una no see me, make una know say I dey helep our gofmen do dia work for Ukraine with my guonguoro.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Nearly 2 million evacuated as deadly Typhoon Ragasa slams into southern China, after killing at least 17 in Taiwan

Nearly 2 million evacuated as deadly Typhoon Ragasa slams into southern China, after killing at least 17 in Taiwan

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

Tiwa Savage denies dating Wizkid, clarifies past relationship rumours

 ‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

‘No thinking, no programmes’: Jerry Gana blasts Nigerian leadership, laments rising prices

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Delta community cries out over collapsed bridge, abandoned road projects

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Portuguese club sign five players from Lagos-based Tonic FC

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

Why Trump's comments on vaccines and paracetamol risk child health

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

'Emotions got better of me' - Ekitike's 'stupidity' opens door for Isak

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

More than 80 buffaloes drown in Namibia after falling off cliff

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

How 3-yr-old BUA Foods became most valuable company in Nigeria

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

10 African countries with the lowest quality of life in 2025

On Sept. 10, Oracle’s stock price surged by more than a third at market open, pushing Ellison past Musk. However, the Tesla CEO regained the top spot by the end of the day, with Bloomberg valuing Musk at $384.2 billion and Ellison at $383.2 billion.

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Larry Ellison, briefly the world’s richest man ahead of Elon Musk, shows off multi-million-dollar supercar collection

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

Klitschko hardest puncher I faced – Joshua

The tiny South African town the United States wants to control

The tiny South African town the United States wants to control

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

IBM fires 8,000 employees and replaced them with AI, only to Rehire just as many shortly after for Jobs

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

South Africa joins Egypt, Morocco, Ethiopia, Kenya, Nigeria, and other African countries facing new charges under the new US travel Visa program: everything You need to know

Would-be Trump assassin tries to stab himself in neck after guilty verdict

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Obi, Ngige, Ihedioha, others grace Amaechi’s son, Chikamkpa, traditional marriage in Abuja

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

Trump criticises countries' migration and climate policies in scathing UN speech

Wednesday, September 24, 2025 10:30 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025