Updating your news feed...

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.


























Loading banners
Loading banners...


NUSA Presido Collins Ngbo
The Nigerian Union South Africa (NUSA) don tok say dem don kpai one Nigerian guy for South Africa as dem dey attack pipul wey come from oda contri come stay South Africa.
Na NUSA Presido wey im name be Collins Ngbo na im tok say give dis tori.
For di tori, Ngbo tok say na for im store for one place wey dem dey call Kimberly for north side for South Africa na im many pipul just come attack John wey be say na Ogun state e from come. Di mata hapun February 12, 2022.
John come still tok say na just 3 months ago na im John wife born pikin.
Wey e dey tok wetin cos am wey pipul come atack John, Mgbo say na one bad gang for South Africa na im attack John sake of say dem tok say e buy laptop wey dem thief.
Dem beat im and im friend but dem no do anyting to de person wey dem say e thief di laptop.
Di NUSA president say John try to survive well well for hospital but e nofit make am lass last.
Ngbo yan say John buy di laptop from one South Africa guy wen tiff di laptop for pesin hand.
“Dis Naija guy so come still sell di laptop give anoda Naija guy. When dem come call dis oda guy e come tok say di laptop no dey wit am again but im go pay put,” na so Ngbo tok.
Ngbo come still yan say: “Di owner of di laptop bin first gree o say make dem pay but later im come bring guys come John shop and dem bin wan obtain e phones,e no gree. Na so dem come begin beat am yege yege till e die.”
Ngbo say oda Naija guys wey dey dia come rush John go hospital but doctor tell dem later say im brain don damage kpata kpata.
(Nelson Dafe na im put dis tori for pidgin)