NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
I use style look for mirror, my broda, di ting wey I take my mouth see, my eye no fit talk am. All my four passenger dem for back seat don naked patapata, dem wan begin do isekuse for inside my guonguoro. Olorun Oba o!
I match break fiiaaam. I park well and come down. I go to back door. Dis people no even hear say I don stop.
Na so I open di back door, see as dem rush, come dey struggle to wear dia clothe. But e dey too late. I tell dem make dem wear dia clothe and come down.
Dem ask me why. I ask dem why dem wan begin do dat kind ting inside my guonguoro, say na abomination.
Na so dis four bobo and sisi begin insult me o! Noting wey dem no tell me. Dem say I be old school wey no sabi anyting. Dem say wetin concern me driver and wetin dem dey do for back, weda I no know say na Val dem dey do.
As dem dey talk all dat bla, bla, bla, I don already open door down. I no talk. Dem see say I mean business. Na so all of dem come down. Na so I begin dey go my way. Awon omo bruku!
As I drive enter our garage for Ikeja, I see Sikiratu waka wan comot. E wait make I park come down.
I call am “My Siki Babe!” Come see as Sikiratu begin hala. E say, “Who be your Siki Babe? Who you dey deceive? My Siki Babe ko!” I shock.
I ask Sikiratu weda everyting dey okay. E say make I no ask am dat kind question. E say if no be say I be agbalagba, e no wetin e for do me now.
Sikiratu say I must tell am who I go do Val with wey make am come siddon wait for me since morning.
I tell Sikiratu say I no do Val with anybody, instead na so so passenger I dey carry since morning.
Sikiratu look time, e say “na 3pm in di afternoon be dis.” Na so Sikiratu open passenger front door of my guonguoro and siddon. E say make I enter my pilot seat. I enter. E say make I begin move. I ask am wia we dey go. E say make I no ask am any question, make I jus begin dey go.
As I dey nack una dis tori so, I never recover from wetin I see for Sikiratu hand inside dat short-time house for Shogunle dat yesterday wey be Val. All my body still dey nack me kom kom. Tori Olorun!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.