Na yesterday I see Lagos bobo and sisi dem for action. Everywia you enter, you go see bobo and sisi gum body like super glue.
Na so I carry one bobo wey say make I go drop am and im sisi for Bar Beach. Since wen we drive comot for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na so dis bobo and im sisi no let me concentrate.
Di two both of dem siddon for back seat, but I use style look dem for mirror. Come see as dis bobo use im hand dey play piano for inside di sisi kini. Tori Olorun!
Di sisi nko? Na so e jus comot di bobo kini, put am inside im mouth and begin do like say e dey chop cucumber. Dem do sote I nearly drive my guonguoro under trailer for on top IBB Bridge. Olorunmaje!
As I drop dem for Bar Beach, na dat time I breath down. I come talk am for my mind say, all dis small small pikin dem no go kill person becos of Val o.
I drive comot for Bar Beach, I say make I take Bonny Camp and begin face CMS, from dia back to Ikeja. Na for front of Palace Hotel, before Bonny Camp, anoder bobo and sisi stop me. Di bobo say make I carry dem go Airport Hotel. Di sisi say no. E say na Sheraton Hotel e wan make di bobo carry am go for Val.
Na so dem tanda dey argue which hotel dem wan go do Val dat yesterday till I drive comot for dia. Who get time to waste?
I no even reach CMS wen anoder bobo stop me. Dem be four – two bobo and two sisi. Di bobo wey stop me say make I drop dem for one hotel for Anthony Village. I tell am my price, e gree.
Instead make three of dem enter for back, one for front, all of dem wan enter for back. I talk tire, dem no gree. Wetin I go do? After all na dia money I dey find.
I no even put my guonguoro for gear one, wen I begin hear piom, piom, piom for back. I look mirror, I see say di four of dem don begin play ajasco for dia body.
Di next ting, I hear one of di bobo say, “Babe, please come on me. Can’t wait to have you right in here. Can’t you see Tom and Caro are about to dig it too? Make it fast, babe. Come on me.”
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.