Hurray! I don catch my VAL

News Express |8th Feb 2022 | 820
Hurray! I don catch my VAL



Yesterday I carry plenty passenger dem. My guonguoro no rest from morning wen I reach our garage wey dey near Ikeja under bridge, till night.

I jam lucky dat day gan. Na so passenger jus dey flow from left, right and center.

I first carry one bobo dat morning go drop for Alapere. As di bobo come down, anoder passenger stop me, e say make I carry am for drop go Mile 12.

Di passenger no even come down finish sef wen one sisi like dat say make I go drop am for Ikorodu. As I drop di sisi wan revise back, anoder passenger say e wan take me for charter till 6 O'clock pm in di evening.

I look time, 12 O'clock pm in di afternoon don nack. I tell di bobo how much e go pay for 6 hour charter, di bobo no jus argue. I tell am make e enter. Di bobo tell me say I go first carry am go Shogunle for Oshodi, from dia to Olorunshogo for Mushin, den to Ojuelegba.

And na so I drive dis bobo as e talk. Tank God say di bobo no waste time for all di place we go. E go jus tell me to stop, e go open door come down and enter di house wey e dey go. Before you close eye and open sef, di bobo don come out and enter motor again.

Na so we do till we reach Ojuelegba, di bobo pay me my money complete. I look time, e remain small make 6 O'clock pm in di evening nack. Na im I say make I begin dey go back our garage for Ikeja.

E come be like say one sisi like dat dey wait make I turn my guonguoro. Di sisi say make I carry am for drop go Ikeja GRA. I happy well well say na my route. I say make e enter.

Tank God say Go slow no too much from Fadeyi reach Maryland before I enter GRA go drop di sisi for Isaac John street.

Dat time, night don dey come. And money full my pocket. I come talk am for my mind say make I cool down small before I begin go my house for Abule Egba.

I come tink am say, to begin go Madam Shine buka near Airport Hotel dat time, I fit jam go slow for road, na im I jus enter one joint like dat for inside Ikeja GRA, begin nack My Usual.

My broder, make I no lie, as I dey nack My Usual, na dat sisi wey I come drop for GRA dey my mind. Di sisi fine no be small.

Everyting for dat sisi body jus stand attention. Headlamp na helele. Boysquarter nko? Dat one na who send you come. Di sisi sabi package im body no be small. I sure say na Packaging Science dat sisi study for school.

Which day I go carry dat kind find sisi again? Na im I jus dey tink.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 12:05 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025