Di bobo wey I carry for drop near Aswani tell di first sisi wey call am for phone say e dey for airport, say e dey fly go Abuja till month end, so e no go dey Lagos for Val.
E tell di second sisi wey call am say im grandma jus peme for village and na February 14 be burial, so im no go dey for Lagos for Val.
Na so dis bobo get tori for all di sisi wey call am becos of Val. And na honey e dey call all of dem o.
Di bobo come call one sisi wey e wan take do Val. I hear am as e call di girl Loveth.
I come talk am for my mind say na wa o! Man dey call woman and woman dey call man to book for Val. But na di one wey dem like, dem go take do di Val dat day. Di rest na extra.
I come dey look dis my passenger ti-ti-ti. I no know weda make I beg am say make e dash me one of di extra sisi wey dey try book am for Val.
But I no sabi di bobo before. And I no come know how all dose sisi dem wey im no wan take do dis Val look like.
If I beg di bobo and e gree dash me one, and di sisi come for dat Val day but e come resemble Ojuju Calabar nko?
Na im make I say make I beg my people here, anybody wey get extra Val wey dey kamkpe, make e give am my number. Helep your broda follow do Val. Abeg.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.