ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

Abeg who get extra Val? 

News Express |1st Feb 2022 | 897
Abeg who get extra Val? 



We don enjoy Happy New Year finish yesterday, na Val everybody dey talk dis new month.

Noting wey we no dey take our eye hear and our ear see for dis taxi driver work wey we dey do for Lagos.

Na everyting we dey hear - di good, di bad, and di OBJ, sorry, na sleep of tongue. Abeg make una helep wake my tongue up. I no wan troublem o. I sure say una know wetin I wan talk sha.

Since dis new month show face dis morning, na so so Val I dey hear for di mouth of all di passenger dem wey I carry. Sisi dem, bobo dem, even plus including agbalagba dem, na Val everybody dey talk.

I carry one sisi dis morning go drop for Ilasamaja. Di sisi siddon for back.

Since di time wey di sisi enter my guonguoro for our garage wey dey near Ikeja under bridge, na so so call e dey answer. Small time di sisi come dey talk. I tink say na me e dey talk to. I say ehn?

Di sisi say na all dis sugar daddy dem o. I ask am wetin do di sugar daddy dem. E say make I no mind dem, say dem get wife for house but dem dey find small small girl wey dem go take do Val.

I ask am weda Val na person name abi na dog.

Di sisi come tell me say Val na 14 of dis month wey man and woman, boy and girl dem dey do kurukere waka from morning till night, and all sisi dem go collect report card after nine months. If you get good luck you pass, if you get bad luck you fail. I say is dat so?

As I drop di sisi for Ilasamaja, I revise enter Express and begin face Oshodi, one bobo like dat stop me near Aswani. Di bobo say make I carry for drop go Mafoluku.

Na so di bobo come dey receive call upandan like dat sisi wey jus drop. I talk am for my mind say today na today.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Saturday, June 21, 2025 12:54 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025