ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

I no dey close eye sleep again

News Express |28th Jan 2022 | 847
I no dey close eye sleep again



Di son of man don enter big troublem. I swear!

I dey do my work jeje di order day o. I go drop one passenger for Dopemu. As I come back for our garage wey dey near Ikeja under bridge, I see my two woman pikin dem dey wait for me.

I wonder waiting make Bisi and Funke find me come garage wen be say all of us sleep for di same house and na from house I come garage dat morning. Di two both of dem get phone, why dem no call me before dem come?

Afraid come catch me. I come dey tink weda someting happen to dia mama. Abi fire burn Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey we dey live for Abule Egba? Noting wey I no tink?

As I come down for my guonguoro, I ask my two woman pikin dem waiting happen. Dem say dem jus say make dem branch garage come greet me as e be say dem come see dia church member for Anifowoshe wey near our garage. Tori Olorun!

Small time dem say dem wan begin dey go house as dem don see me. Na so I bring out money for my shokoto trouser, give dem for danfo. I tell dem say I fit close late today, make dem tell dia mama.

As dem wan go, Funke remember someting. E say wen dem dey wait for me, one sisi find me come, say di sisi name na Sikiratu. E say di sisi follow dem wait for me small before e talk say make e go back for im workplace.

Na so dem begin go house o. Olorun Oba o!

As dem jus comot for garage, one passenger waka come. E say e wan carry me for charter. E say e wan go buy market for Kotangora, from dia I go carry am with di market go drop for Alapere, Ketu.

I tell am no troublem. I tell am my price, e gree. Na so we begin dey go.

Night don come wen I drop di passenger begin go my house. Wen I reach, my wife Bose don set food for me as I baf finish. Wen I dey eat, my wife jus dey look me ti-ti-ti. Small time e go come smile wan kind smile like dat. My wife come dey over nice dat night.

Wen we enter for bed to sleep, na im Bose begin scratch my back. I say na wa o. I no fit remember which year my wife scratch my back last. My wife wey be say now, if my body make mistake touch im body for bed, e go shift go end of di bed patapata , and face di wall. E go say all im body dey pain am.

Small time dat night, Bose ask me: "Baba Bisi, who be Sikiratu?" E-l-e-d-u-m-a-r-e! No wonder!

I come talk am for my mind say, na wetin Bisi and Funke come tell dia mama for afternoon? Wetin dem discus with Sikiratu wen di three both of dem dey wait for me for garage?

I no come know wetin I go answer my wife. In short, I confuse. I come begin form sleep, I begin dey snore. Na so Bose come dey laugh. E no come ask me about Sikiratu again. But I sabi say, as e no ask me so, e get plan.

Na im make since dat night till today, I no dey sleep with my two eye close. If I sleep patapata and Bose come use hot iron for midnight, press all my body make I kukuma peme nko? Abi una no hear di one wey happen for dis same Lagos dis week gan? Olorun maje!

Abeg make una put me for prayer.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Saturday, June 21, 2025 1:03 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025