NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Dat Sunday night na wa o.
One passenger like dat book me say Sunday evening I go come carry am for im house for Emmanuel Bus stop for Agege, go drop am for Ajah.
Road clear well well becos say na Sunday. E no be like order days wey person go dey inside go-slow sote motor go begin do over heat.
I drop di passenger for Ajah 9 O'clock pm in di evening, na im I put my guonguoro for revise, begin face mainland.
I no even go far wen two bobo like dat stop me. I match break fiiaaam. Dem say make I go drop dem for Unity Road for Ikeja. I see say na my way, I tell dem di price, dem gree. I say make dem enter. One of dem siddon with me for front, di second one siddon for back.
Dis two bobo dem vex gan. Dem jus dey hala. I come dey wonder wetin go make dis two bobo vex like dat. And I no fit ask dem. My own na make I carry dem go wia dem dey go, dem pay me and come down. Datsol.
I come dey use style dey put ear for wetin dem dey talk say make dem vex.
Di ting be say dem dey for dia friend place for Ajah dey watch dat Naija football match with Tunisia dat Sunday.
Wen di match finish and Tunisia give Naija one kpondo, na im di two bobo lef dia friend place, enter road to go back to dia house for Ikeja. And e come be say na my guonguoro dem see for road dat time.
Come see vex! Di one wey siddon for front jus dey curse one person wey I no know. E say e no go better for Eguavoen wey allow dat oga use phone call Naija boys dem dat Sunday morning before di match.
E say how Eguavoen no get sense to know say dat call go bring bad luck for Naija team?
Di bobo wey siddon for back talk say to say im know, e for jus dey sleep for im house dat Sunday, instead make e go dia friend place for Ajah, sote e begin wait to follow watch dat badluck match.
E say how come Eguavon no remember say dem beat Joshua for ring like person wey tief iPhone 13 after e go dobale for di same oga . Di bobo say e never see oga wey go bless person, e go turn to curse.
Since wen I drop di two bobo for Unity Road for Ikeja before I begin go my house for Abule Egba dat Sunday night, up till dis time wey I dey nack una dis tori so, I still dey tink who be Eguavoen, who be Oga Badluck and wetin come concern phone call with football loss.
According to di two bobo, if Eguavoen know say di phone call go cause katakata, why e allow im boys to pick di call?
Eguavoen, why nau? Tori Olorun!
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.