Wen di two bobo with big belle jus enter our garage wey dey near Ikeja under bridge, I see as dem waka go meet our union chairman, Jimoh.
All my mind be say dem be passenger wey wan take taxi for drop of charter.
Small time, I see Jimoh point hand for wia I siddon, na so di two bobo begin waka dey come my side.
As dem reach me, dem smile and say “Ahh, good afternoon Oga MAT. It’s our pleasure meeting you.” Dem shake my hand.
Me, I no kukuma know who dem be. I jus dey look dem like say I drink one drum of lookozade dat morning.
Dem come tell me say dem come from Alausa.
Na dat time I come greet dem well well. I tell dem to siddon for di bench wey we dey take siddon for our garage.
Di one wey im belle big pass open im bag, bring out file. E bring out one paper like dat for inside di file and give me.
Di second bobo talk say na Oga patapata of Lagos State send dem come meet me. Dem say make I carry di form go my house, look am well well, fill am, add my passport photo and bring am come Alausa tomorrow by 10 o'clock am in di morning.
Dem say di office and person wey I go meet wen I come dey for dat form.
My body come begin dey shake like Shakespeare. I come talk am for my mind say na wetin I do wey make Oga patapata send people come find me for garage? Tori Olorun!
I no kill person. I no jam person car. All my particular complete. Dem say make we dey carry two fire quencher, I get two. Dem say make we dey renew license for one year, as I dey so, my license reach 2024 sef.
Since dis year start, I no get any wahala with VIO, LASTMA, Road Safety, Council or even KAI.
As all dis ting dey run for my mind, na im one of dem tell me say make afraid no catch me, say Oga patapata wan make me Chief Driver for Alausa. E say in fact, na me go dey drive Oga Sanwo-Olu gan gan.
I use style pinch my body weda na dream I dey dream, I see say no be dream. Olorun modupe lowo yin o!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.