ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

My new year miracle don land

News Express |18th Jan 2022 | 906
My new year miracle don land



Any time I remember how I take land for Lagos, di ting dey make me wan cry. But why I go cry, wen di bad ting don turn to better ting?

I sure say everybody remember di tori. No time to begin nack una di tori again. Infact, I don tire to dey tell una how Arike Papa been wan take African Insurance finish me say na me give im pikin belle.

No time to begin tell una say no be me give Arike belle. Only be say di two both of us dey siddon togeder for di same table for Standard 5 for di night school wey we dey go for my village for Ogbomoso.

Time no dey to begin tell una say everybody for our village shock as Arike Papa no gree say body touch body no fit give im pikin belle.

No time to talk how I run comot for village come be mecho apprentice for Lagos. How I buy second hand car, wey still be like tear rubber, for oyibo hand wen Biafra war wan start.

No time to begin talk how I don use dat oyibo car since after my mecho apprentice, till today wey I dey use am do my taxi driver work. And dat car na im be dis my guonguoro.

No time to tell una how I use dis my guonguoro marry my wife Bose, den come born my two woman pikin dem - Bisi and Funke. And na di same guonguoro I dey take maintain my family, pay rent for Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey we dey live for Abule Egba.

Na im make I talk am tele tele say I no regret say Arike Papa make me run comot for my village come Lagos. Na better ting dat wicked man do for me, but e no know.

I dey for Lagos hear say dat wicked man don peme. To say e still dey, one day I for go tank am as e make me run comot for village come Lagos. Na so, so better tings don dey follow me since dat time.

See like yesterday, two bobo like dat waka enter our garage wey dey near Ikeja Under Bridge.

Di two bobo wear coat and tie. Dia belle shoot out like say e remain one week make dem born pikin. Wen you see dem, you go jus know one time say di bobo dem dey chop better money.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Saturday, June 21, 2025 1:05 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025