ADVERTISEMENT
ADVERTISEMENT

My New Year Swear (2)

News Express |7th Jan 2022 | 1,025
My New Year Swear (2)




Our union chairman Jimoh new year swear be say, e wan begin do state politics becos of 2023 wey dey come so.

E say e don ready to go join MC Oluomo campaign. He say patapata di King of Oshodi go make am commissioner wen e become di next gofnor.

E say na only dat time e go fit see money take care of im 7 wife and 45 pikin dem wey scater all over Lagos.

Our union treasurer Idowu say, e no go touch any sisi, even im wife, dis year, as e be say any woman wey e jus touch small go born twins. E say dis new year o, na rubber or noting. Chikena!
Emeka own be say, e dey always reduce im taxi price make all di passenger dem wey come our garage dey use only im. But di jibiti been come affect im business well well last year wey make am never still see money marry wife for im village, Nnewi, up till now. Now Emeka say dis year, na wetin everybody charge passenger e go follow charge.

Akpan nko? E say all di chuk chuk wey e been dey chuk any ting in skirt don stop dis new year. E say e be born again now, make e no come carry AIDS go give im wife for house.

Na so I come dey tink wetin me sef go do, or no do again, dis new year.

Shey na My Usual wey I dey nack for Madam Shine Buka every evening wen I close for work before I begin go house for Abule Egba?

But if I stop My Usual, shey na all dis jedi jedi I go come dey shack?

Apart from dat, I remember Sikiratu, Iyabode, Aisha and even Jumoke - and all dose Lagos sisi dem wey no dey allow me face my taxi driver work as I suppose to.

Abi make I marry second wife dis year make e come dey scratch my back every night as Bose say e don become old mama and everywia for im body dey pain am now?
I still dey tink of my own New Year Res... Reso... Resolu...

Abeg make una helep me complete am.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Saturday, June 21, 2025 4:02 AM
ADVERTISEMENT
Over 70 years Shell banner
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025