NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
As we enter Costain sharp sharp after all di babanla go-slow for road, di bobo sef surprise gan. E show me di office wey I go drop am. Wen we reach, e bring out my money and pay me.
As e open door wan go down, e tell me say, “You are a highly experienced driver. You must be di best taxi driver in Lagos.” I jus tell am tank you.
Di bobo collect my phone number and give me im card. E say na me e go dey use anytime e need taxi. I tell am tank you.
Na so di bobo begin go. Me sef revise my guonguoro, enter road again, and begin go my way.
I look di card wey di bobo give me. I no know say na a hole company chairman wey I carry inside my guonguoro, go drop for Costain so. And if you see dis my passenger, you go tink say na one kind small boy e be.
So, all dis big oga dem dey do like common people now make dem no kidnap dem!
As I dey go, I count di money wey di passenger give me, I see say e don add extra 5k. Na so I begin pray for am.
I say im money no go ever finish lai lai. Im own no go ever baje. No amu robber, kidnapper abi im senior broda gbomo gbomo go see am, and im no go see dem lai lai! Na me dey pray and na only me dey answer Amin! Amin!! Amin!!!
I pass stadium reach Barracks, instead make I face Ojuelegba, I say make I branch Tejuosho market go find wetin I go fit buy for my family for dis Keresimasi.
As I branch Ojuelegba dey go small, na im I hear puuuaaarrhh! Afraid catch me weda na gun dem shoot. Na wen my guonguoro no gree move again, I know say wahala don shele.
I clear and park for road side. I come down. I see say my front tire don bend go one side. And no how wey di motor fit move again. Olorun Oba o!
Forget say I dey do taxi driver work, I be original mecho. And I know say to fix wetin happen for my guonguoro go chop better money wey I no even make since January. No be moi moi.
And e come happen for dis kind dry time wen everybody dey cry for money.
Na so I wind up, lef my guonguoro for dat street, enter danfo and begin go my house for Abule Egba.
As I dey nack una dis tori so, my guonguoro still dey for Tejuosho. And e come be say na for dis Keresimesi and New Year week my guonguoro come pack up. Tori Olorun!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.