NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Wen some kind tings happen, person go look up, look down. E go come be like say make ground open make person enter, but di ground no go gree open.
Yesterday morning, one bobo like dat come our garage wey dey near Ikeja under bridge. E say make I carry am for drop go Costain. I tell am my price, e gree. I tell am make e enter.
We no even reach Sheraton for Airport Road wen we meet one kind Go- slow like dat. In fact, dat one no be go-slow sef, na standstill.
I tink say di ting start for dat Leventis bus stop before Cantonment.
I chuk head put for Ikeja GRA, take Isaac John, say make I go burst out for traffic light for dat Leventis junction. Na so we go jam di grandpa of all go-slow.
As all di road for GRA tight reach, to go forward na wahala, to revise back, na wahala. Na so we remain inside di standstill ti-ti-ti-ti.
I come talk am for my mind say weda make I tell my passenger make e come down, make I go back to garage. But I come remember say, even if di passenger go down sef, how I go take turn my guonguoro begin dey go garage wen everywia don block patapata? Tori Olorun!
Na so we dey move small small till we reach Maryland by 11 o'clock am in di morning. We don spend 3 hours inside Ikeja GRA!
I say make I begin fire dey go, make we cover di time wey don go. If you see me and my guonguoro dat day for Ikorodu Road, you go tink say I be dat oyibo wey dey do America cinema. E be like say my two woman pikin dem – Bisi and Funke – dey call am James Bond.
I fire climb Ojuelegba bridge, land for Barracks, fly on top of Stadium bridge, to Alaka.
Before you open your eye sef, we don enter Costain.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.