NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Dat day, I ask una to tell me wetin I go do as Sikiratu say make we stop to do lovi lovi becos one bobo wan marry am for new year. And as e come talk say na me e love and na me e for like marry but e no wan be second wife.
Since I nack una dat tori, di small memory for inside my torch light chinko phone don full patapa. Na orisirisi sms people jus dey send to me since dat Friday.
To carry passenger sef na wahala becos na so, so sms I dey read from morning till morning, every day.
I know say na me use my hand take find troublem wen I talk say make people advise me how I go take handle Sikiratu concerning dis kind matter.
Yesterday morning, I read sms ti-ti-ti-ti since wen I wake up. My wife Bose come ask me weda I no wan go garage. I tell am I go begin prepare dey go.
Bose comot go out come back, I still dey read sms. I no even know wen e don come enter room, still come meet me dey read sms dey go.
Na im Bose come do like say e dey clear im throat, na dat time I jump up like say electric shock me for yansh.
Bose ask me wetin dey inside my phone wey I jus dey read like book.
I tell am say na one business like dat I dey pursue. I say, as keresimasi don come so, I must to find money wey I go take make family enjoy.
Bose look me, I look Bose. Den e come tell me weda na for inside dat my small chinko phone business wey go bring money dey.
E come ask me wetin I dey do since January wey I no begin find di business, weda na now my own day break.
Bose say before I begin do gbomo gbomo or Yahoo Yahoo, make I take am easy for dis end of year o. And make I remember say if I do anyting make olopa carry me today, na for inside cell I go peme becos no money anywia to take dash olopa for bail.
Small time, Bose come near me, e say make I show am dat business wey dey inside my phone.
Na so I use style off di phone sharp sharp. I come do like say I vex well well say phone battery die.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.