Sikiratu like me, and me sef like Sikiratu, dat’s all.
Sikiratu call me yesterday. I tink say na becos of di Xmas and New Year long list wey e give me last week.
As I pick di call, I tell am say I never forgot. Sikiratu ask me, “forgot what?” I tell am say I know say e wan remember me di list.
Sikiratu say no be becos of dat one e call me. E say e wan come see me for our garage wey dey near Ikeja under bridge. E say e get one serious matter wey e wan come tell me.
I tell am say I dey for garage, make e begin come kia kia before passenger show face.
E no reach 10 minute, Sikiratu don land. Di way im face dey, I know say someting serious don shele.
Sikiratu tell me say e no fit sleep for night till dis morning. E say di ting wey dey worry am na how e go take lef me.
E say one bobo like dat wan follow am go do introduction for im papa and mama. E say di bobo don dey tell am to marry am since dat Koro lockdown last year, but e dey use style dey post di bobo.
Sikiratu say e don gree for di bobo now becos e know say I no fit marry am.
E say number one, I be agbalagba. Two, I don marry and e know say I no ready to marry second wife. Anoder ting be say, if me and im continue with dis our lovi lovi, time dey go and husband fit no come remain again for am.
Sikiratu say make di two both of us stop everyting 31st December night becos na for new year di bobo wan marry am.
E say di bobo na fine young bobo, but dat e like me gan pass di bobo.
E say but noting spoil sha. If I ready to marry am, e go fashi di bobo one time!
Sikiratu come give me condition. E say if I ready to marry am, e no go be second wife. Tori Olorun!
I come ask am weda e wan make I sack my wife. Sikiratu say na me talk dat one. E say im own be say, na me e for like marry, but e no wan be second wife.
Sikiratu say make I tink about wetin e tell me so, e go come back tomorrow for reply. E say di ball dey inside my court now.
Na so Sikiratu begin dey go o.
My people, abeg make una tell me how I go take handle dis matter.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.