NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Since wen I come dey do dis my taxi driver work for Lagos, I dey mind my business, I no dey for woman matter.
Any time I remember say na becos of Arike I run comot for my village for Ogbomoso come Lagos, I no dey like to near woman rarara.
See me see wahala o. Me and Arike dey siddon for di same table for Standard Five wen we dey go our village night school.
Small time, Arike say e don get belle. Arike Papa say na me give im pikin belle. I tell am say becos Arike body and my body dey touch everyday for class no mean say na me give am belle. Dat wicked juju man wan use African Insurance finish me, if no be say I run come Lagos.
I first dey do apprentice for mecho work, after my freedom, I begin do bus conductor before I come get lucky wen I take buy dis my guonguoro for Oyibo man hand. If I tell you how much I take buy am, you no go believe. E jus be like say na dash di oyibo dash me di car.
Since dat time, na di car I dey drive till today. Na im I take marry my wife Bose sote we come get two woman pikin dem - Bisi and Funke.
Na di guonguoro I take dey pay my rent every month for di Baba Braimoh face-me-I-face-you house wey we live for Abule Egba.
Na di guonguoro I take send my two pikin to school till dem come jam JAMB dis year wey make dem one enter uniservity so.
Na all dis ting make I dey respect mysef since I come Lagos. If no be so, I for don enter plenty troublem for all dis Lagos sisi dia hand. Bose kuku dey talk am every time say Lagos taxi driver work na ashewo work. And na true.
Di only sisi for dis Lagos wey I fit talk say me an am dey, na Sikiratu wey dey work for Madam Shine buka near Airport Hotel.
But if I tell you say me and Siki Babe never do, you go believe?
Na only two times me and Sikiratu go short time house for Oshodi. We do everyting togeder but e come be say na dream. I swear! If I lie make I baf naked for bafroom.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.