Ashewo don cause katakata for garage

News Express |2nd Nov 2021 | 930
Ashewo don cause katakata for garage



If you see some people, you go tink say dem no fit harm ordinary fly sef. But na dose kind people sabi waka kerukere pass.

I been tink teletele say I sabi di character of all our union member dem well well.

Atlist, I know say our union chairman Jimoh, like to dey show say e get money too much. Na im make e marry seven wife and e rent house give dem one by one.

I no sure say Jimoh even sabi how many pikin e get.

Idowu, our union treasurer own be say, as im nyansh flat so like China man own, if e jus touch any sisi one time, na belle straight, and na twins di sisi go born.

Dat's why we dey call am Baba Ibeji. Idowu get twins full everywia for Lagos.

Emeka own be say, e ready to carry passenger from our garage wey dey near Ikeja under bridge, go drop for Obalende and collect N500 kpere. Emeka sabi spoil market for us, no be small.

Na im make plenty passenger dey always wan make Emeka carry dem. And di ting dey give am plenty money everyday pass we wey dey collect official union rate.

Akpan own na woman. Akpan dey like anyting wey wear skirt for body. If you use skirt cover stick, Akpan go chase dat stick, even wen e know well well say dat ting na stick, no be person.

One day I ask Akpan weda dem take woman curse am for im village before e come do taxi driver work for Lagos.

Mutiu nko? Dat one na igbo be im own - Wee wee! Any time you see Mutiu eye red like fire, make you know say e go don smoke like twenty raps of igbo. And if e drink monkey tail to take wash di igbo down, na so so smile Mutiu go dey smile even before you talk to am sef.

All of us been tink say Mutiu no dey near woman rarara.

Na so all of us complete for garage di order day becos of di union meeting wey we dey do every week.

As Jimoh jus tell Idowu make e use prayer close di meeting, na so one sisi like dat jump enter our garage. Di sisi rush enter our meeting.

If you see wetin dis sisi wear for body, afraid must to catch you.

Di wig for im head don fall go one side. Di jeans skirt e wear na super mini, e no fit bend down small sef becos if e try am, everybody go see everyting wey dey for yonder.

Di blouse e wear nko? E for better make e no wear anyting sef. Di blouse be like plain glass, everyting for di sisi body jus show, and na so di two pawpaw wey dey im chest jus dey dance konkoma as di sisi dey waka.

If you see di sisi, you go jus know say dis one na ashewo wey go don collect long service award.

As di sisi jus enter our meeting place, e hold Mutiu for shokoto trouser and begin shout.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Tension as factions battle for PDP secretariat

Tension as factions battle for PDP secretariat

FG receives Benin bronzes repatriated from US

FG receives Benin bronzes repatriated from US

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

Off-duty US pilot who tried to crash plane midair will not serve prison time

Off-duty US pilot who tried to crash plane midair will not serve prison time

Shelters plea for Gazans as winter rains raise fears of more disease and death

Shelters plea for Gazans as winter rains raise fears of more disease and death

Tuesday, November 18, 2025 10:18 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025