New wife: Troublem sleep, yanga go wake am

News Express |19th Oct 2021 | 942
New wife: Troublem sleep, yanga go wake am



Abami Eda don sing am teletele say, “Wen cat sleep, rat go bite im tell, na wetin e dey find? Na palava e dey find. And na palava e go get”. Dat song na true. I swear!

Shebi una remember last week wen I talk say vacancy dey, say I wan marry new wife? My broda, I no know say I don cause serious palava for mysef.

I hear nwi dat day wey I say make all di candidate for new wife bring dia application come meet me for our garage wey dey near Ikeja under bridge.

Before I reach garage dat morning, every wia don full sote our union member dem no see chance drive enter di garage. Me sef no see way drive my guonguoro enter. Applicant dem wey come for di new wife screening pass 1,000. Tori Olorun!

Come see orisirisi shape and size of nyansh and headlamp – small, medium, big, large, extra large, extra extra large, etc, etc.

As dem jus see me dey come in my guonguoro, na so dem rush me. I no know how dem take know my guonguoro.

Before I stop sef, dem don open my door. Four of dem jump inside passenger front seat, seven jump inside di back seat. And I never match brake o.

As I manage stop, di rest of dem don surround my guonguoro. No way for me to even open door and come out.

Di ones wey don jump inside, give me dia application. I no collect. I say make dem hold dia application first, say I wan collect everybody own at di same time.

Di one wey near me for front say na lie I talk. E say I must to marry am. Two for back say if I no gree to marry dem, na me and dem today. Dem say dem be twins and di two both of dem wan be my new wife.

Anoder wan tell me say e be graduate, and e don dey find work since 9 years wey e comot for uniservity, up till now e no see work. E say na im make e don decide to forgot about work and marry. And im lucky come shine wen e see di vacancy for new wife wey I talk last week. E say e no go lef me today lai lai.

Anoder wan talk say shebi I complain say my wife Bose no dey gree give me kini, e say if I marry am, everyting wey dey for im body na me get am, and e dey ready for me anytime of di day – morning, afternoon and night. And even if I wan lef di ting inside im kini till day break, e dey kampe. Olorun Oba o!

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Akin Osuntokun: Nigerians ‘romanticising rogue behaviour’ as Military violates constitution

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinapa handover by AMCON Marks ‘Rebirth’ of Cross River’s economy, says Governor Otu

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Tinubu: Public perception of Judiciary not favourable, Judges must shun corruption

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Lagos N200bn bond oversubscribed by 55% at N310bn

Tension as factions battle for PDP secretariat

Tension as factions battle for PDP secretariat

FG receives Benin bronzes repatriated from US

FG receives Benin bronzes repatriated from US

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

People will answer for financial recklessness in museum Project — Edo Commissioner

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

PDP Govs Responsible For Crisis In Party — Anyanwu

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Dangote clarifies drop in petrol pump price

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

Egypt FA confirm talks for EARLY Mohamed Salah release for AFCON

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

NMDPRA: We will not allow cartels take over downstream petroleum sector

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Ex-Harvard president Larry Summers steps back from public role after Epstein email release

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

Switzerland joins Italy, France, Austria, Germany, Netherlands, Hungary and more as Canada faces tough new travel requirements for European trips in 2026: New updates you need to know

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

BREAKING: Heavy security presence as PDP factions hold parallel meetings in Abuja

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

The top 10 most peaceful countries in Africa 2025

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Ondo Refinery, FTZ Project Take Shape with Formalized JV Platform

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

Serial intruder who accosted Ariana Grande at Wicked premiere in Singapore sentenced to 9 days in prison

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

International soccer’s 148th-best team is pulling crowds of nearly 50,000 people

Off-duty US pilot who tried to crash plane midair will not serve prison time

Off-duty US pilot who tried to crash plane midair will not serve prison time

Shelters plea for Gazans as winter rains raise fears of more disease and death

Shelters plea for Gazans as winter rains raise fears of more disease and death

Tuesday, November 18, 2025 10:20 AM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025