I wan begin wear suit drive my guonguoro

News Express |20th Aug 2021 | 1,108
I wan begin wear suit drive my guonguoro



Dis my taxi driver work don come dey sweet now. I know say every work get im own wahala. E get di good, di bad and di OBJ, sorry, na sleep of my tongue. Na ugly I wan talk o, I swear! Abeg helep me wake my tongue up before e put me for troublem.

Yesterday, I siddon for our garage wey dey near Ikeja under bridge, dey look road weda passenger go show face.

Small time, my torch light chinko phone begin ring grin, grin, grin! I look am, I no know di person wey dey call. Name no show. I no pick.

Di person call again. I no wan pick, make e no be all dis 419 people wey dey disturb person every time.

Di person call again. I say na wa o. I jus say make I hear wetin di person wan talk. I talk am for my mind say, if na 419, I go jus swear babanla swear for am.

“Hello, is dat Oga MAT?”di bobo ask. As correct Naija man, me sef use question jam im question. I say, “Na who dey call?”

Di bobo come talk say im name na Mr. Dada. E say I carry am go drop for Sheraton Hotel last week. E say e give me im card and collect my number dat day. I come shout, “Oga Dada!”

I remember Mr. Dada well well. Na one passenger wey I no fit forgot lai lai. Di man nice gan. Na big oga for Sheraton Hotel.

I remember dat day wen e say make I go drop am for im office for Sheraton, say im motor get wahala as e dey come for road dat morning, and e tell im driver make e carry di motor go mechanic village go fix am.

Dat day, di man jus enter my guonguoro, e no price me. And me sef no talk, as I see say na big oga dis man go be. If I tell you di kind money wey dis man pay me jus to drop am for im office, hmm, you go begin jealous me.

So, wen I come greet Oga Dada for phone dat yesterday, e ask me wia I dey. I tell am say I dey for garage. E say make I begin drive come im office now, now, now.

Before you close your eye open sef, di son of man don reach Sheraton.

Oga Dada say e wan make I carry four oyibo go airport. E say oyibo plenty pass di long bus wey di hotel get, and e like di wey I drive am dat day wen im car spoil for road.

Na so my belle come sweet gan. I tell Oga Dada say im wish na my command. After all, I no get anoder work pass to drive taxi.

20 oyibo enter di hotel bus, di remaining four enter my guonguoro. Before we begin move sef, Oga Dada give me one envelope, but I no open am. Na so we begin go airport. I dey for front, di bus with 20 oyibo dey for my back.

I see say di driver wey carry di 20 oyibo wear one better suit like dat. I come shame as I wear ordinary shokoto and jjumper carry oyibo go airport.

Wen I drop di four oyibo for airport, as I open di envelop to see how much Oga Dada pay me to carry di four oyibo go drop for airport, my broda, I nearly faint wen I see say na dollars dey for inside di envelop.

But I no go tell una how many dollar, make I sleep with my two naked eye closed for night. I no wan wahala.

Now na to change di dollar, enter Ipodo market go buy cloth give tailor make e sew better suit for me wey I go dey wear drive my guonguoro as international taxi driver. Olorun modupe lowo yin o!

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very very much indeed.

Comments

Post Comment

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Tuesday, November 18, 2025 3:15 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025