Dis business get weight gan (4)

News Express |17th Aug 2021 | 1,000
Dis business get weight gan (4)



As I carry my head up look for my right as me and di three bobo siddon for dat Palmgrove joint, I see one man wey resemble one olopa inspector wey I sabi for Area F for Ikeja. Di man siddon for chair after my own. E do like say e no know me. Me sef do like say I no see am sef, make e no come tink say I catch am for bad joint.

Small time, di phone of di bobo wey been siddon for front wen we dey come begin ring. E answer di call. After, e tell di order two bobo say dia oga dey wait for dem for di operation place. Dem pay money for di drinks and pepper soup.

Di four both of us stand up go enter my guonguoro to go meet dia oga for wia dem wan do di operation dat night.

As we jus comot for di street wey di joint dey, na so olopa van block us. Di olopa wey dey inside dat van pass twenty, all with gun.

Na so di olopa order me to stop. Dem say make all of us come down and carry our hand up for search. Na dat time I see dat olopa inspector in mufti wey siddon near for dat joint.

Di bobo wey siddon with me for front wan bring out gun to shoot olopa, na im di olopa inspector quick quick hammer di bobo two bullet for head ppuuaarr, ppuuaarr!! Di bobo head scatter patapata.

One bobo get up to run, anoder olopa fire am bullet for back, and na so di bobo fall inside gutter and peme. E come remain one of di amu robber. Dem put dat one handcuff for im hand, put am inside olopa van, and begin go station.

I surprise say olopa no jus touch me. E come remain only me and dat inspector in mufti wey siddon near me for dat joint.

Di inspector come shake my hand. E say, “Oga MAT you be correct man”.

E say na dat call wey I quick quick call OC Crime dat time wey I go piss before I drive di amu robber dem comot for our garage, na im helep dem get di amu robber dem. E say im don dey drive follow us for back since wen we comot for garage dey come Palmgrove. E say na as we enter di joint siddon, na im e signal all di order olopa dem to come wait for us.

Na so I jus begin tank Eledumare as e give me common sense wey no common. Olorun modupe lowo yin o!

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Tuesday, November 18, 2025 3:13 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025