Dis business get weight gan (2)

News Express |10th Aug 2021 | 1,106
Dis business get weight gan (2)



As di bobo tell me say I go pack my guonguoro face one direction wey be say, wen dem finish, dem go rush enter and I speed off immediately, someting come dey tell me someting inside my ear.

For dis Lagos o, noting wey we taxi driver never see. Na orisirisi passenger dem we dey carry everyday. So wen any passenger begin talk, we sabi wia e wan land.

If na ashewo, we know. If na gbomo gbomo, we know. If na Yahoo Yahoo, we know. If na ordinary tief sef wey dey pick pocket for bus stop, we know. Amu robber nko? We know.

Na im make, as di bobo mouth dey run tatatata like typewriter, I know wia e wan land. But I jus dey do like say I be mumu.

Wen e talk finish, I tell am say sebi e know say na night duty be dat. E say im know, but no be TDB. I tell am say weda TDB or no TDB, night na night, no be day time.

I wan use ogbonge price take discharge am, but I shock wen di bobo gree to pay. I come talk am for my mind say today na today. Di business wey dis bobo wan go do for Palmgrove for night with im boys get weight gan.

I gree with am say I go carry im boys go Palmgrove. I look time, na 2 O’clock pm in di afternoon. I ask am di time wen im boys go come meet me for garage. Di bobo point hand for di order side of di road near under bridge. I see there hefty bobo dem tanda dey look as me and dis bobo dey talk.

E come tell me say di boys dey ready. E say e go signal dem now make dem cross road come for garage. E say I go carry dem go one joint near Palmgrove wey we go wait till night before di operation start. Olorun Oba o!

I ask am what kind of operation, di bobo jus carry im shirt up small make I see di small gun wey e carry. Den e come use im fingers do sign of shooting gun ta ta ta. Tori Olorun!

See me, see amu robber dem. So, na me dem wan use as dia driver. Na im be say if I carry dem go for di operation, me sef I be amu robber.

But as e dey now, as dem don already tell me di kind business wey we wan go do, no how wey I go take comot my head. If I make any nonsense move now, dem go jus waste me one time.

Na so hot piss come begin worry me. I tell di bobo say make e signal im boys make dem cross road come enter my guonguoro for garage make we dey go kia kia.

(To be continued)

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

Osun 2026: APC Stakeholders call for disqualification of Omisore

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

45 kidnapped victims regain freedom under peace accord in Katsina

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Don't blindly trust what AI tells you, says Google's Sundar Pichai

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

Guns boom, teargas rains as Wike, Bala Mohammed, Makinde, others battle for control of PDP National Secretariat

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

TD Africa takes centre stage at Schneider Electric Innovation Day Nigeria 2025, signs landmark MoU for AI-powered data centres

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Full chat between Gen. Uba and rescuers before his capture and execution by ISWAP terrorists

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

Canada warns against travel to Nigeria, 16 other African countries in latest security update

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

US Religious Freedom Coalition hails Trump for designating Nigeria a Country of Particular Concern, urges swift action

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Outrage as Nigerian immigrant stabbed to death at home in South Africa

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Tension in Enugu community as Gov Mbah's kinsmen protest military invasion

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Kebbi Abduction: How my daughter escaped after bandits killed my husband — Vice Principal’s Wife

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Genocide: U.S. lawmaker alleges Tinubu lying, protecting own interest

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

Anambra Assembly worker dies over inability to repay loan as workers begin indefinite strike

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

VDM, comedian Mr Jollof risk jail over in-flight fight

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Strike: FG’s ‘No Work, No Pay’ threat will escalate looming crisis — SSANU president

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Nigerian doctor sent to prison in UK for $268,000 fraud

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Tinubu has less than 600 days to be flushed out — PDP chieftain

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Key facts about proposed UK asylum system reforms

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Northern Governors condemn abduction of schoolgirls in Kebbi

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Mbah okays 2025 promotion exercise for Enugu civil servants

Tuesday, November 18, 2025 3:13 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025