Dem wan make I sign guarantor for Ashewo

News Express |16th Jul 2021 | 1,029
Dem wan make I sign guarantor for Ashewo



Yesterday as I drive dey come from my house for Abule Egba, go reach our garage wey dey near Ikeja under bridge, I no see even one passenger carry.

I reach garage, siddon from morning till afternoon, no passenger show face.

I come siddon dey tink wetin dey happen. So na like dis Naija don bad reach? Abi na all dis Uber, Bolt, BRT and all di orisirisi transport wey don come out make man no dey see passenger carry again?

People no like to dey use dis our yellow taxi again. Na im make I siddon for garage dat yesterday afternoon dey tink which kind business I go begin do.

But e no easy rarara. Na now wey I don dagba finish I go come change di work wey I don dey do for Lagos since before Biafra war? You sef tink am.

Na all dis ting I siddon dey tink wen Mama Kudi wey dey sell agbo for front of our garage come meet me. E come with one sisi like dat.

Mama Kudi say e happy say e meet me for garage, say e wan make I helep im junior sister do someting.

E say im sister name na Bukky. I look di sisi, I see say dis one pass ordinary sisi. If you see as dis sisi take pancake plaster im face, layer by layer. Den come use lipstick paint im mouth pure red.

Eye lashes and nails nko? Dat one long like eagle own.

E no end dia o. If you see di kind clothe wey dis sisi wear, hmm, e for better sef make e waka naked. Tori Olorun!

Mama Kudi collect one paper for Bukky hand, give me. I ask am wetin di paper be. Mama Kudi say na guarantor form.

E say Bukky dey live for Ajegunle before, now e wan come live for Ikeja but di landlord wan make person sign guarantor for am.

I ask am wia di house dey. Mama Kudi point hand for Ipodo. I ask am weda na for Ipodo dey house dey, e say yes. E say na Hotel Afrricana.

I ask Mama Kudi weda na di same mama born di two both of dem, e say no but e sabi Bukky wen e dey sell agbo for one hotel for Ajegunle wey Bukky dey work but now, gofment don seal di hotel, na im make everybody find im way.

I ask am which kind work Bukky dey do for hotel, e say e dey hustle. I ask am which work be hustle. Na im Mama Kudi use low voice talk say Bukky na ashewo. Olorun Oba o!

Na im I tell di agbo woman and im ashewo sister say, if I count three and dem no run comot for my front , make dem no blame me for anyting I do dem.

My broder, dem no wait make I count one sef, na so dem took off.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Atiku blames Tinubu, security chiefs after ‘killing’ of Brig-Gen Musa Uba in Borno

Atiku blames Tinubu, security chiefs after ‘killing’ of Brig-Gen Musa Uba in Borno

Tuesday, November 18, 2025 4:51 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025