Abeg who get tokunbo A/C?

News Express |6th Jul 2021 | 1,045
Abeg who get tokunbo A/C?



Afraid don dey catch me well well.

Dis one wey JAMB keep pikin dem for house till today, I no come sabi again. Shey na wen all di woman pikin dem wey dey wait to enter Uniservity carry belle, na im JAMB go say make dem enter school?

Since wen my two woman pikin dem – Bisi and Funke – jam JAMB last year, na so dem siddon for house morning, day and night.

JAMB talk say chance no dey for Uniservity until di people wey first enter Class One before Coro show face last year, enter Class Two, na im chance go dey. And anoder set jus take JAMB finish last week o. Tori Olorun!

But Funke tell me for weekend say, e be like say dia set go soon enter school. I come happy well well.

Na im make I talk am for my mind say, all di money I go make yesterday for my work, I go keep am make my pikin dem take enter school.

Di only ting be say, dat yesterday morning, as I dey drive my guonguoro dey go for our garage wey dey near Ikeja under bridge, I jus dey tell Eledumare say make I see passenger carry nyafu nyafu.

And true, true before I reach garage sef, one bobo like dat stop me for Odun Eran bus stop before Pen Cinema.

Di bobo say make I carry am for drop go Bode Thomas for Surulere. I tell am my price, e gree. I say make e enter.

As we begin dey go, di bobo ask me weda I no go put on A/C. I tell am say I no get a/c. See as di bobo shout for my head. E say make I stop make e drop kia kia. Na so I match break o. Di bobo jump down, e no look my side again.

As I reach garage, I say make I siddon small weda passenger go show face.

Na so one oga and madam waka enter garage. Di oga point hand for my guonguoro and ask who get am. I rush go quick quick.

Dem say make I go drop dem for Marina for Lagos Island. I tell dem my price, dem say no troublem at all, at all.

Before I open back door make di two both of dem enter, di madam ask me weda I get A/C. I confuse.

I say yes, sorry, no. Di madam ask me weda na yes and no at di same time. I tell am sorry, say I no get A/C. If you see di kind bad eye dis madam take look me, hmm, e reach to give small pikin convulsion.

Di madam hold oga hand and say, “Darling let’s go and get Bolt. Forget this old school yellow taxi.”

Na so I take miss all di passenger troughout dat yesterday becos of A/C, like say dem plan am. And na so I go back to my house for Abule Egba dat yesterday night without shi shi for pocket.

Abi na di handiwork of my village people for Ogbomoso?

How my pikin dem go take go school as dem wan start school so?

Na im make I dey find A/C to take put for my guonguoro kia kia. Even if na tokunbo, I no mind. If I no fit pay di money one time, I go dey pay small small till e finish before new year.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 6:26 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025