Chidinma ke? No be me and you! (2)

News Express |2nd Jul 2021 | 1,014
Chidinma ke? No be me and you! (2)



As di sisi change im clothe finish for inside my guonguoro, di next ting be say, e come bring out lipstick, pancake and mirror.

Before you say Oga MAT, di sisi don turn im face to Egugun. If you no look am well well, you go even tink say na Ekpo Calabar you see. By dis time, we don pass Iyana Oworo, dey face Alapere.

Di sisi come tell me say make I dey fire my guonguoro, say e don late for night duty. E say if I no move fast, all im clients fit go finish for Opebi and Allen Avenue.

I look time, 9.30 O’clock pm in di night don nack. Na so I begin match trottle ti-ti-ti-ti.

I come take style ask am which kind night duty e dey do. Di sisi ask me weda I jus come for Lagos. E say if I wan know di night duty wey e dey do, make I branch any nice hotel wen we reach Ikeja.

Small time, I feel two hand for my back. I look mirror, I see say na di sisi wan begin dey do touch touch for my body make my kini wake up. I talk am for my mind say, I don enter am dis night.

Di next ting be say, di sisi move from back seat to front, while I still dey fire di guonguoro dey go o! Tori Olorun!

As e jus siddon for front, e carry im mini skirt up, e say make I bring my right hand, I obey. E carry my hand, put for on top im kini, den use im left hand to untie di rope of my shokoto trouser, and begin take my kini play Akwete. Olorun shanu mi o!

E say any ting wey e dey do with my kini, make me sef dey do di same ting for inside im own kini. I no know wen I begin speak Latin: Totoriscomamapussi!

Na so we dey do ise ku se till I nearly drive go jam NEPA poll for dat 7-Up road wey dey go Alausa Secretariat.

Di ting come sweet me no be small. E come be like say dem put fire for my body. As di two both of us dey work with hand dey go, na im I come dey tell am say, “Stop am, I like am. Stop am, I like am...!” like record wey don crack.

I say make I kukuma park for roadside for di real action, make I no go come peme.

As I park, na im di sisi say make I off all di light for my guonguoro. I obey kia kia. Na only dat Alausa street light come dey on, nobody fit see us inside

Dat time everyting for my body don stand paparapa like Standard Bank, and na so all my body come dey shake like Shakespeare.

I come manage tell am say, all dis one wey we dey do so , I no know am, e no know me. I tell am say my name na Oga MAT. Di sisi tell me say im name na Chidinma.

Ewo! Chi wetin? Olorumaje! Na so everyting for my body come die patapata.

Di sisi surprise gan.E ask me wetin happen. I tell am say I wan piss for gutter. E say okay, make I do quick come back.

Na so I go forgutter, go do like say I dey piss. As I come back, I tell am make im sef go piss come, so we go begin do di real ting.

Na im di sisi bend down for gutter begin piss.

Quick, quick, I jump inside my pilot seat, open ignition, start engine, put am for gear one. Come see me dey fire dey go like mad man.

Chidinma ko, Ataga ni.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 6:26 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025