Funke say belle dey pain am

News Express |25th Jun 2021 | 1,113
Funke say belle dey pain am



Dis life get as e be. Person go work, work, work, e no go get chance siddon for house small.

Na dis our taxi driver work bad pass. Di son of man dey always dey for road 24/7.

If person no work like dat, wia e go see money maintain im family? And me I no ready to put hand for any bad ting to take get money.

Na im make, e dey pain me some times say I no really get time to siddon with my family to see how dem be.

Di ting come be say, my two pikin dem – Bisi and Funke – na woman pikin. And you know say no be moi moi to bring up woman pikin. I swear!

Since wen my second pikin, Funke tell me yesterday say belle dey pain am, my mind jus dey shake like Shakespeare.

And Funke and im senior sister Bisi don jam JAMB after JAMB jam dem for five years. Dem don dey prepare to enter uniservity dis year, wey go make me and Bose be Pama and Mama graduates soon.

Dat yesterday, Funke jus use style dey rub im belle wen e dey eat with im sister for night, e no know say I dey take corner eye dey look am with agbalagba eye.

Small time, Funke run go backyard, nobody ask am wetin e run, lef food wey e dey eat, go do for backyard.

As e come back, e use water take rinse im face and mouth, e say food no hungry am to eat again. E say belle dey pain am. E wash hand, as e wan enter inside house, na im e hold im belle run go backyard again. Tori Olorun!

I call im Mama quick, quick. I ask am wetin dey do im pikin. E ask me which pikin. I say Funke. As a correct Naija person wey must use question to answer question, my wife ask me wetin I see say dey do Funke.

I tell Bose say okay, di assignment wey I give am be say, make e put im eye down and check Funke well well from head to toe, and give me di report tomorrow morning before I carry my guonguoro enter road for morning.

Up till dis time wey I dey nack una dis tori so, I still dey wait for di report.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 6:28 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025