Helep! My wife Bose don start anoder wahala (3)

News Express |22nd Jun 2021 | 1,031
Helep! My wife Bose don start anoder wahala (3)



Bose come talk say, im friend come house yesterday wen I don go work.

I ask am which im friend, e say Paulina. E say if I see di kind phone wey Paulina bring come. E say di phone name na iPhone 7. E say noting for dis world wey di phone no dey do. E say Paulina tell am say e buy di iPhone 7 N350,000 only.

I tell Bose make e go straight to di point.

My wife come tell me say di torch light chinko phone wey e don dey use since 2001 dey shame am now. E say e wan buy iPhone 7.

I no know wen I shout, Olorun Oba o!

So, wen I go my work, dat Paulina wey don run comot for im husband house, lef dia four pikin, dey come dey tell my wife to buy iPhone 7?

And na dis same Paulina tell my wife say e don see dat oyibo night duty casino work for am o!

Di way I vex dat midnight ehn, if I no control my body, di ting wey I for do Bose, hmm, di hole world for hear am.

Di ting wey I do be say, I tell my wife say I dey come, make I go piss for backyard.

Na im I use style go knock our nebor Yemisi door make e open for me. I tell Yemisi make e no vex, say I wan sleep for im room till day break.

Yemisi ask me wetin happen for my own room, I tell am say make e no worry, I go tell am for morning.

Na me and Yemisi lie down for di 6 inches bed wey dey im room. I dey hear as Bose wake Bisi and Funke up, say make all of dem dey find me, weda dem don come kidnap me. I jus dey laugh.

I come talk am for my mind say monkey don jam banana today. Yemisi, di only sisi wey be tenant for dis our Baba Braimoh face-me-I-face-you house, wey don dey find how e go kidnap me tey tey.

My broda, na from Yemisi room I comot for early morning begin rush go our garage wey dey near Ikeja under bridge. I switch off my torch light chinko phone.

Up till dis time wey I dey nack una dis tori so, Bose dem still dey find me.

Make we jam again on Friday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.

Comments

Post Comment

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

Man kills soldier with log of wood in Lagos, neutralised without delay

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

There’s Christian genocide in Nigeria, we welcome US intervention — CAN

Why I slept with our maid — Married man tells court

Why I slept with our maid — Married man tells court

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

One of 25 abducted Kebbi schoolgirls escapes as army intensifies search for others

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Organ-harvesting: Police nab suspect, rescue 4 victims

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Nigeria's Oluwafunke Adeoye wins 2025 IBA Outstanding Young Lawyer Award

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Lagos court sentences randy man to life imprisonment for defiling minor

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Sacrilege: Yobe community condemns grave’s desecration, pledges to support police investigation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Lagos Govt. postpones planned Lekki-Ajah road rehabilitation

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Alleged abuse of office: Otu dissolves Cross River LG Service Board

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Saheed V The People of Lagos: When security is life (1)

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Open Letter to President Tinubu: Serial disobedience of court orders – Urgent request for Executive Intervention in the prosecution of Mazi Nnamdi Kanu and consideration of a nolle prosequi

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Ebonyi Labour Party chieftain drags alleged attackers to court

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

Catholic Priest shot dead, several residents abducted as gunmen storm Kaduna community

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

44 Federal Lawmakers write Tinubu, seek Nnamdi Kanu’s release

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Pro-Wike PDP NEC expels Makinde, Bala Mohammed, Bode George, others

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

Security fears deepen over schoolgirls’ abduction, slain General amid new assaults

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

APC group charges Nentawe not to reduce his office, to focus on delivering Tinubu

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Gunmen kill Ebonyi commissioner’s brother

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Senate halts consideration of Cocoa Management Board Bill after Tinubu’s request

Tuesday, November 18, 2025 6:25 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025