NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Tori full ground o. Wetin I like for dis my taxi driver work be say, noting wey happen for Lagos and Naija as a hole wey I no go hear.
Yes nau. If you carry passenger dem, na so so tori dem go dey nack for inside. Dem go even forgot say di taxi driver get ear.
Even if na one person take di taxi, all di tings wey e dey talk with order people dem for phone, e go also forgot say di taxi driver get ear.
Since dis week, all di passenger wey I carry for my guonguoro na one ting dem dey talk about. Everyting now na twitter, twitter, twitter. Tori Olorun!
I carry two madam like dat yesterday. Dem come for our garage wey dey near Ikeja under bridge. Dem say make I carry dem go for Maza Maza for Festac Town side. I tell dem my price, dem gree. Na so we begin dey go Maza Maza.
Since di time wey we comot for garage, pass Airport Road, comot for Charity bus stop, to Iyana Isolo, Cele, Ijesha, Mile 2, pass Festac gate, den go reach Maza Maza, na so so twitter di two both of dem dey talk.
As I drop dem, say make I begin go back to my garage for Ikeja, one bobo like dat stop me for dat Maza Maza side. E say make I go drop am for Lawanson.
Dat one sef na im bad pass. Since e step im leg into my guonguoro, di bobo jus hang for phone non stop. I no know weda MTN or Airtel or 9mobile abi na Glo, dey dash am credit. Olorun Oba o!
Wen di bobo talk with one person finish, e go call anoder person. Before e talk with dat one finish, anoder person go call am. Di ting sef nearly wan disturb my work. Di orisirisi call and ringing no come let me concentrate. And na so, so twitter e dey talk for phone.
I jus dey listen, but I no come get di real gist. I hear as e talk say, twitter delete one talk like dat wey sombori talk. Den e come talk say di sombori now dey talk say na twitter dey support all di bad bad ting wey dey happen for dis contry. And e say di person say e wan deal with twitter squarely. But my passenger come laugh big man laugh, e say for wia di sombori go see twitter, make e remain to deal with am?
I nearly wan ask my passenger who dis twitter be sef and who make am vex sote e delete wetin sombori talk, and who be dat sombori wey dey plan to fight twitter becos twitter delete im bad talk?
But me I come talk am for my mind say, shey, di sombori no fit delete twitter too as twitter delete am, instead make e begin plan how e go fight twitter wey dem say e no fit see lai lai?
Na wa for dis Mr. Twitter o! E get power no be small!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.