Wonder no go ever end for dis world. Na orisirisi tings dey happen every day.
Na we taxi driver dey see pass. Noting wey no dey happen for Lagos road - di good, di bad and di... (Abeg helep me complete am. If you like, put di Baba Iyabo or di BAT, na you sabi. No be for my mouth dem go hear am)
Naija people dey cry say money no dey. Na lie! Money dey, only be say di ting no reach everybody.
Yesterday two bobo like dat waka enter our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Dem say make I carry dem for charter go Sango Ota. I tell dem my price, dem no jus argue. I tell dem make dem enter, me sef jump enter my captain seat.
Na as I move my guonguoro enter Obafemi Awolowo Way, begin face Ikeja Council, na im I notice say two white Hilux dey follow us for back.
Wen di two bobo see say I notice, one of dem tell me say make I no worry, say di two Hilux dey with us.
Wen we reach Sango, dem ask me weda I sabi wia Obasanjo Farm dey. I laugh. I tell dem say no wia wey I no sabi. I ask dem weda dem know my name. Di two both of dem talk am at di same time say “Oga MAT!”. I shock.
I ask dem how dem take know my name. Dem say anybody wey no know Oga MAT for Lagos, na im be say dat person never born.
Dem say even dia oga sabi me, dat is why dia oga tell dem make dem come charter my guonguoro join di two Hilux.
I ask dem who be dia oga, dem say na councillor. I come talk am for my mind say so all di councillor dem sef sabi me, plus including chairman.
I come tell dem say, I sabi everywia, na im make our union member dem give me dat name Oga MAT. I tell dem say dat MAT mean “Man About Town”. Before I even talk am finish sef, we don land for Obasanjo Farm. Dem surprise.
Na so we begin load turkey for di farm. Dem say councillor wan use di turkey do Happy New Year for im people.
Turkey full di two Hilux, den come full my guonguoro sote di two bobo no see chance siddon for my guonguoro again. One of dem go manage for di first Hilux, anoder one go join di second Hilux.
Na so we chuk head put for road again, begin dey come back with full load of turkey.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.