NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
I no even finish to tell una say I wan block some people for my torch light chinko phone becos of two much beg beg for Xmas and New Year, anoder one don come.
Yesterday I go drop one passenger like dat for Balogun market wey dey for Isale Eko.
Di kind Go-slow wey dey for IBB Bridge wen we dey go dat morning too much, na im make I say make I take Costain as I dey go back to our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Na dat one come bad pass sef. From Costain to Stadium come take di same time wey person go drive from Lagos reach Benin city.
Wen you escape dat one, you go begin crawl for inside Go-slow from Ojuelegba to Fadeyi. And Ikorodu Road come block patapata. Tori Olorun!
By di time I manage pass Maryland, Sheraton, Toyin den Ikeja Roundabout, 12 O'clock pm in di afternoon don nack. Dis na Isale Eko wey I go drop passenger since 7 O'clock am in di morning o. Olorun Oba o!
I come dey talk am for my mind say, abeg make all dis Omo Ibo wey full for Lagos come dey travel go dia village for dis odun make person see road waka for Lagos.
As I manage reach our garage dat yesterday, I say make I rest small na im my phone begin ring grriinnn...grriinnn!!! I look di number, I see say na Sikiratu dey call. I pick am.
I ask Sikiratu wey e dey call from, e say na im work place wey be Madam Shine buka.
E ask me weda I no see di text message wey e send to me wey make me never reply since morning.
I tell Sikiratu say I jus dey come back from Isale Eko wey I go drop one passenger since morning. I tell am say Go-slow nearly finish me for road inside dis hot sun.
Sikiratu say make I lef my long tori and check di message for phone.
Wen I see Sikiratu sms, I nearly faint.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.