NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Yesterday our union chairman Jimoh been talk say, as year don dey end, make we try come early today (Tuesday) and hold di last meeting for dis year 2020. We all been gree to meet by 8'oclock a.m in di morning today so dat we go dey free all day to do our work.
For night, my wife Bose no let me sleep straight sleep. E say we must to do bend bend sleep. Bose complain say e don tay gan wen I touch am. E say e dey suspect say na all dose Lagos sisi dem wey I dey see for road everyday no allow me get time for am.
Bose say, evening night wen I come back for house, I go baf, eat and sleep. For morning again I go jump up and begin dey go garage with my guonguoro.
Na so Bose hold me for work till day break (TDB). I dey even dey beg Bose make e remember say I be agbalagba o. Bose say dat one na me sabi. E say I must to perform my duty, dat’s all.
Na im make, dis morning as I open my eye, I check time, na 7.30. Tori Olorun!
Na me be Akowe for our garage and meeting time na 8.
I jump up, rush go wash my face for outside. I wear my shokoto trouser and jumper, carry key, jump inside my guonguoro and took off. I no brush teeth, I no baf, I no eat becos Bose and my two woman pikin dem – Bisi and Funke – still dey sleep. Olorun Oba o!
As I jus drive enter di expressway for dat our Abule Egba, na im my torch light chinko phone begin ring grin grin grin!
I look di phone, na one special number like dat dey call me.
(To be continued)
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.