NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Una sabi say na me be di Akowe of our union. We gree yesterday for our branch meeting make we send dis letter to Oga Olopa for Abuja:
"20/11/2020
Dear Oga Olopa,
Bring back your boys or...
We all di Lagos taxi driver, plus including di ones for our garage wey dey near Ikeja under bridge gan gan, sabi say you and your family dey kampe. If so, we tank Eledumare.
We write to tank you for all di good work wey your boys dey do, becos e no easy for person to dey pursue di kind ogbonge criminal dem wey full for Naija.
But di ting wey come worry us for our union be say, since wen #EndSARS finish, you no come allow your boys dem come dey do dia work again. Why?
Shey na becos of dat small quarrel wey #EndSARS pikin dem get with una, na im make una come vex comot for road patapata? Haba!
Shebi na small pikin #EndSARS dem be nah. We sabi say plenty of your boys peme, and dem also burn plenty of your bank, sorry, station too.
Abeg make una no vex. Na small pikin dem be. I sure say dem been wan make una sef know as people dey feel wen una dey arrest, shoot and kill order people pikin, papa, mama, husband, wife, broda and sister. Abi una tink say e dey sweet people?
But even at dat, we still dey beg you, as dia oga, to send your boys back.
If na dat 50 naira wey dem dey force us collect for dia road block, we no mind to continue to dey pay dem. In fact, we even dey tink how we go increase am sef.
But sha, make your boys come back. We go know how we and dem go take settle dat one. We also know say wen we increase, dem go dey make better return to you. (Oga, we see say you don dey smile).
But we wan ask you two question, abeg make you no vex o:
One, as your boys no gree come work again, shey you go still dey use our tax money pay dem salary wen month finish?
Two, all di gun wey dem carry go house for dat #EndSARS, wetin dem dem dey take am do now? How we sure say no be di gun dem don dey carry go tanda for road in mufty, and enter house to house every night, so dat we go begin cry say amu robber don come plenty now becos your boys no dey road again?
But weda or wedan't na true, abeg, Oga Olopa, tell your boys to come back to work.
If afraid still dey catch dem, helep us tell dem say we, di Lagos taxi driver dem, no go allow anybody touch dem again.
We even ready to sign free surety for dem, no be like di bail wey dem dey tell us say na free for dia station, but before you comot for dia, dem must to empty your pocket.
But make I tell you o, we also talk am for di meeting say, if after one week you receive dis our open letter, and your boys no gree come back to do dia work, we go tell Amotekun to take over, dat mean say you and your boys no go get work again. Abi you wan try?
One word dey enough for who get ear.
Tank you.
Sign:
Olufemi Olurotimi Olugbemiro a.k.a Oga MAT
(Secretary)
Jimoh Abdul Mustapha
(Chairman)
For and on behalf of all Lagos taxi driver dem.”
My people how una see di letter? Sebi e good.
Make we jam again on Tuesday.
Tank you.
Tank you very much.
And tank you very, very much indeed.