NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Nobody go fit make me run for dis Lagos lai lai.
Di ting wey make me run comot for my village for Ogbomoso no fit happen to me here. I don learn my lesson.
Even as e be say no be my fault, na becos of woman I run come Lagos, come learn mecho work, after dat I come dey do dis my taxi driver work since dat time before Biafra war.
Me and Arike dey siddon di same table for Standard 5 for our village night school.
Small time Arike carry belle, Arike papa come talk say na me give im pikin belle. How? Why? Who? When? What?
Shey, jus becos my body and Arike body dey touch for class, dat one reach to give Arike belle?
Everybody for village sabi say Arike papa na wicked man. Di man wan use African Insurance finish me, na im I run come Lagos. Since dat time, my leg no touch my village again. But I hear say di juju man don peme tipe tipe.
Na im make, since I come Lagos, I no dey play with all dis Lagos sisi dem any how. Even Sikiratu wey don enter me gan, I know as I dey take waka with am. I be agbalagba now, nobody fit try dat ting wey Arike papa do again. Na who born di baga? Shey di person dey craze?
Aisha don dey try to enter me four years now. Any time e come sell Ewa Agoyin for our garage wey dey near Ikeja under bridge, Aisha must come see me.
Even if I carry passenger go drop some wia, Aisha go use style wait for me till I come back.
I no know wetin dat mobile buka girl dey find for my body. And Aisha and Sikiratu dem be friend o.
Na so Aisha carry market come sell for garage yesterday. All our union member dem complete, as passenger no dey show face since wey di BRT buses wey dem burn remain don dey enter road again after #EndSARS.
Dat yesterday, Aisha wan bring down im market wey dey for im head. Akpan wan helep am bring am down, Aisha no gree. Emeka sef stand up to helep am, e no gree. Our union treasurer Idowu and our chairman Jimoh sef try, Aisha no gree. E no even jus look Mutiu side at all, at all.
Na so Aisha come for wia I siddon. E say, “My darling Oga MAT abeg helep me carry am down.”
As I stand up to helep bring down di Ewa Agoyin for Aisha head, na im all our union member begin hail me “Oko iyawo! Oko Aisha!!”
As I use bold face helep Aisha finish, na so Aisha come give me one kind hot kiss like dat fiiom! I confuse.
But since dat yesterday, na so so Aisha dey for my mind. I sleep, I see Aisha. I dream, I see Aisha. Even wen I dey eat, na Aisha dey my head. Tori Olorun!
Afraid dey catch me now make I no come lie down for bed with my wife Bose one night and begin dey call Aisha. Olorun maje!
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.