NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Even dough at times some tings dey make me feel like
say make I go back to my village for Ogbomoso, I know well well say na for dis Lagos I go make am. Helep me say Amin!
I still dey wait for dat 2015 crossover night vision sha.
Shey una still remember di vision wey Bose my wife dia pastor see for me dat night wey I follow my family go dia church for Pen Cinema?
Na dat crossover night be di first time my leg enter any church. Na only my wife and my two pikin dem – Bisi and Funke – dey go di church. Bisi and Funke sef dey for choir.
As I carry my family go drop for di church dat night, Bose use style lobby me make I wait follow pray make di new year 2016 for better.
Di church full dat crossover night sote plenty people tanda outside. Na for outside I dey wen di pastor from inside come drag me.
E carry me go for altar, e say make di hole church begin fire pray for me. As dem dey pray dey go, pastor talk say e see vision for me. E say e see as I become chief driver for Aso Rock. Una kukuma remember say na dat year Oga patapata enter Aso Rock.
Since dat crossover night, I don dey wait ti-ti-ti-ti for di vision to come to pass. E don be five years now, I still dey wait.
Anoder year wan end now, I still dey do taxi driver work for Lagos.
Na dis ting I siddon dey tink yesterday for our garage wey dey near Ikeja under bridge wen one bobo and one sisi like dat waka enter.
Dem waka go meet Idowu our union treasurer. I see as Idowu point hand at me. Na im di bobo and di sisi waka come my side. Dem bring out one letter and give me. Dem tell me congratulations Oga MAT.
I collect di letter, open am and read.
I no know wen I jump up begin shout, “Olorun Oba o!”
All our union member dem wey dey for garage dat morning rush come meet me. Dem ask me wetin make me happy like dis. I no fit talk, I jus hand over di letter to dem make dem read am.
Government don nominate me for Best Lagos Taxi Driver of the Year Award. Dem say we be 22 wey dem nominate to cover all di local gofment area wey dey for Lagos State.
Dem say dem go begin show our face for television and dem go tell everybody for Lagos to vote. Dem say di winner go become Oga Sanwo-Olu chief driver.
Better don dey show face be dat o. Olorun modupe lowo yin o! Abeg make una vote for me o!
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.