NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
As I fire my guonguoro enter our garage wey dey near Ikeja under bridge, everybody for garage take cover. Dem tink say my brake fail.
Na wen I park and come down dem know say my brake no fail.
I come dey shout, “Wia Jimoh? Wia Jimoh? Jimoh come out!”
All our union member dem wey dey for garage shock, no be small. Dem no come know wetin make me dey behave like area boy dat afternoon.
Idowu tell me say, “Oga MAT calm down. Wetin happen?”
Akpan say, “Oga MAT no dey behave like dis. Di ting wey happen go serious well, well. Oga MAT abeg calm down.”
I come ask dem how I go calm down wen be say only one person take all di palliative wey Oga Sanwo-Olu give us for dat Coro lockdown time.
I tell dem wetin Osagie tell me for Ketu wey make me wan run mad so.
I tell dem say Oga Sanwo-Olu give every Lagos taxi driver palliative –
Rice (1 bag), beans (1 bag), Indomie ( 5 carton), Semo (1 big bag), Ororo (1 gallon). Di palliative even include envelop with N20,000 inside di envelop.
Emeka no know wen e shout, “Chineke me e!”
Na dat time Idowu, our branch treasurer, talk say as di branch chairman, Jimoh no dey now, make everybody calm down.
But Idowu come tell us say na im and Jimoh go Alausa dat Coro lockdown time for di palliative.
As Idowu jus talk dat one, na im I jump hold am for shokoto trouser. I say oya, give us our palliative.
Emeka sef follow me hold Idowu for im shokoto trouser. But Idowu dey beg us to calm down make e talk finish.
Idowu say wen dem reach for Alausa, dem come hold meeting with all di Lagos State exco of our union wey dey dia. Dem tell dem say di Honourable member wey represent us for House don collect all our palliative go keep for warehouse for Surulere. E say di Hon member go tell everybody di day to come collect di palliative for im warehouse.
Idowu say wen dem come back from Alausa dat day, Jimoh call all our member one by one for phone, and tell dem wetin Alausa people talk. But e say my line and Emeka line no dey reachable troughout dat lockdown time.
Akpan and Mutiu come talk say na true, say Jimoh been call and tell dem di same ting.
Na dat time me and Emeka come comot our hand for Idowu shokoto trouser.
I come remember say, true true, my torch light chinko phone been get wahala for dat Coro lockdown time.
Na dat time Jimoh jus drive enter garage.
Jimoh rush come ask wetin happen wey make all of us tanda togeder dey do face like say somebody don peme.
Idowu come nack Jimoh di palliative tori wey cause all di katakata.
Jimoh say, our palliative? E say na di palliative looters go loot for di Hon member warehouse for Surulere during dat #EndSARS protest.
Jimoh say na di palliative wey di Hon member talk say e been keep am to distribute on im birthday be dat. Olorun Oba o!
Na so my mouth jus gum, I no fit talk again.
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.