NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Osagie see say, as e dey nack me di palliative tori, my mind don fly go far. Na im e tell me make I jus take am easy, say na so Naija be.
E say weda I no see as hungry people go burst into all di warehouse for di contry and carry all di palliative. Now olopa say dem be looter. Looter ko, Martin Luther ni! Person wey go hide di palliative for warehouse na im be di real looter. Simple!
Di ting wey jus dey for my mind as Osagie dey tell me dis ting na to rush go Jimoh house for Mushin. I sure say na for dat im house our palliative dey.
Dat kind palliative wey Osagie talk say Oga Sanwo-Olu give every taxi driver for Lagos for dat Coro lockdown time come dey nack for my head pom, pom, pom:
“Rice (1 bag), beans (1 bag), Indomie ( 5 carton), Semo (1 big bag), Ororo (1 gallon). Di palliative even include envelop with N20,000 inside di envelop.”
I no know wen I shout, Olorun Oba o!
I quick, quick bring out my torch light chinko phone from my shokoto trouser. I collect Osagie number and give Osagie my own number. I jump inside my guonguoro and move.
Na so Osagie tanda dey look me as I speed dey go.
I jus dey fire dey go like driver wey SARS (sorry, SWAT) dey pursue for expressway. You kukuma sabi say dat one na do or die matter becos if dem catch you, na dat time you go sabi wetin dey.
All my mind as I dey fire dey go, na to reach our union branch chairman Jimoh house for Mushin now, now, now!
But wen I pass Ojota bridge, enter service lane wey I go pass dat traffic light dey go straight to take me go Oshodi, I come talk am for my mind say e for beta make I first hear wetin Jimoh go talk.
Anoder ting be say, by dis time Jimoh sef no go dey for house, e go dey for work.
So, instead make I drive straight pass di traffic light for Maryland, I turn right begin dey fire dey go Ikeja.
My target na to go reach our garage wey dey near Ikeja under bridge, meet Jimoh and ask him for my palliative.
In fact, no be only my own, na di palliative of all our union member dem for our branch. After all, na me be di Akowe.
And if I meet Jimoh for garage, and e waste one second pere, me sef go become looter for dat im house for Mushin. I swear!
(To be continued)
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.