Noting wey man no go hear and see in di curse (olorunmaje!) of dis taxi driver work.
Tank God say di Lekki toll plaza wahala and all di orisirisi looting don come and go.
Di only ting wey remain now na curfew, but I know say dat one too go pass.
I go drop one passenger for CMS di order day. As I dey come back, two sisi stop me for Costain bus stop. Dem say make I carry dem for drop go Ikeja.
I tell dem my price, dem gree. I tell dem make dem enter. Di two both of dem enter for back seat. Na so we begin dey go.
We no even near Stadium, na im I hear as one of di sisi say e wan wear di dross wey e jus buy for bend-down-boutique for Apapa Road for Costain, to see weda e size am.
Di second sisi say im sef wan wear di bra wey e buy, to see weda di ting go carry up di two apple wey dey for im chest well well.
I jus do like say I no hear dem. I come dey wonder weda na for inside my guonguoro dem wan siddon dey test dia tokunbo dross and bra. I jus face front dey do my work dey go.
Di next ting be say, I see for my mirror as di first sisi remove im yellow dross, open im bag and bring out di white dross wey e jus buy, and wear am. E say, “I dey sure say Gbenga go like dis white G-string wela.” Di old dross fall down, di sisi no see.
Di second sisi sef comot im blouse and di old bra. Come see full headlights o! Di ting jus stand paparapa like Standard Bank, and na so my body come dey shake like Shakespeare. Tori Olorun!
I jus dey pray for my mind make I no drive go enter under trailer for dat express road.
Di sisi wear di tokunbo bra, look am ti-ti-ti, den shake im head say di ting dey kampe.
E put di old bra inside im handbag and wear im blouse back. Dat time we don reach Ikeja Roundabout.
As I jus turn right small, di two sisi say dem wan come down. I match break fiiiaamm. Dem pay me my money.
As dem open di door to come down, I tell di first sisi make e no forgot im old yellow dross for di floor of my guonguoro.
Na so di sisi look down, see di old dross and carry am quick quick.
Di two sisi nearly faint. Dem ask me say, so I dey look all di ting wey dem dey do since, if no be so, how I take know say im old dross been fall down sote I sabi di colour?
One of dem say, e sure say I get camera for inside dis my taxi wey I take dey look dem since.
I jus smile, put my guonguoro for gear one and begin go our garage wey dey near Ikeja under bridge.
Camera ko, camcorder ni. Wetin concern me with camera? Shey una hear say my name na Uncle Fash wey dey discover camera?
Make we jam again on Tuesday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.
NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.