NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.
Dis our Lagos don dey get as e be. E be like say I go begin plan how I go carry my family go back to my village for Ogbomoso.
But di wahala be say, wia I go begin from? My leg no step for my village since I run comot come for Lagos before Biafra war becos of Arike papa.
I no sure weda my papa mud house still dey, I no even sure weda I go still remember di way to di house.
Di kind tings wey happen for Lagos since last week shock me gan. Everywia dey on fire. Na so so tatata person dey hear.
And anytime you hear di tatata, know say na person pikin dem shoot so. Tori Olorun!
As Oga Sanwo-Olu carry curfew go for night, I say make I reach our garage wey dey near Ikeja under bridge. And na dat yesterday all our union member meet for di first time since dat last week.
As we dey greet oursef, dey do long-time-no-see, na im one bobo like dat waka enter our garage. E say e wan carry me for drop go im house for Anifowoshe.
I ask am weda no be im house e come from, why e wan make I go drop am again for house, wen be say Anifowoshe na jus one minute waka?
Di bobo say e wan make I go with am go carry load for im house, den go drop am and di load for Agege market.
I say no wahala. I tell am my price, e gree. Na im we jump enter my guonguoro, begin dey go di bobo house.
As we reach di house, di bobo come down go open im door. Di house na face-me-I-face-you, like Baba Braimoh house wey I dey live for Abule Egba. And e be like say na only di bobo dey live.
As di bobo open im room door, e say make I come see di load wey I wan carry.
To step inside di room sef na wahala. Load don full everywia.
I see like 7 bag of rice, 5 Semo, 6 Indomie, 4 standing fan, 1 office table, 3 A/C and other orisirisi tings like dat.
I tell am say all dis ting wey I see so no fit enter my guonguoro. Di bobo say we fit carry some go drop for market, den come back and carry di rest.
I ask am weda na for im shop for di market e wan go drop di load, e say e no get any shop. E say e jus wan carry am go di market weda e go see people wey go buy am.
I ask am weda e be trader. Di bobo come look me one kind. E say why I dey ask am all dis question. E say weda I no dey for dis Lagos to know di ting wey happen last week.
E say my own na to carry di load go drop am for market and collect my money. Di bobo talk say if I need any of di ting, e go dash me, after all no be buy e buy am. Olorun Oba o!
Na dat time di hole ting come do gengen for my head. My eye come open. So na looter I dey talk with since! Olorunmaje!
Na so I comot for di room quick quick, enter my guonguoro, open ignition, start engine, put am for gear and begin go back to our garage. I come talk am for my mind say, no be me and you!
Make we jam again on Friday.
Tank you
Tank you very much
And tank you very, very much indeed.