Orisirisi facemask na im dey

News Express |11th Aug 2020 | 1,388
Orisirisi facemask na im dey

Work full ground for me last Sunday. E jus be like say na becos of me Oga Sanwo-Olu say make church dem for Lagos open again inside dis Coro wahala.

I carry passenger dem sote my guonguoro hear nwi. Na im make I don plan to service am dis week wey we dey so.

Dat Sunday around 7 o'clock am in di morning, I first carry my wife Bose, and my two woman pikin – Bisi and Funke – go drop for dia church wey dey for Pen Cinema, Agege. I give dem di 3 facemask wey I keep inside my pigeon hole.

As I jus drop my family say make I turn go back house, one man wey tanda with im wife and four pikin stop me.

Di man say make I carry dem for drop go dia church for Oregun. I tell am my price, e gree, I say make dem enter.

Come see di orisirisi facemask wey dem wear. Di man use one black facemask wey dem take velvet sew am. Di wife wear one wey be red Ankara. Dem use anoder facemask wey cover all di face of di baby wey di wife carry for hand. And di madam carry belle o.

Dia pikin dem nko? Di boy wear facemask wey resemble di wrapper wey im mama tie. One of dia woman pikin use one black facemask like dat wey I fit swear say na one leg of im papa old socks. Di order woman pikin wey don mature small wear facemask wey resemble im old headtie. Tori Olorun!

As I drop dem for dia church for Oregun, anoder oga wey tanda with im wife stop me. E say make I carry dem go drop for dia church for Dopemu. I tell dem my price, dem gree. But I see say dem no wear facemask.

I tell dem say I no fit carry dem without facemask, say I no wan enter olopa wahala for road.

Di madam look inside im handbag, e tell di husband say e be like say dem don forgot dia facemask for house.

Di husband say sebi e tell am dat time say make e carry two facemask put inside im handbag. Na so di two both of dem begin argue for road o.

Madam open di door of my guonguoro and enter. I tell am say sebi I don talk am tele tele say I no go carry dem without facemask. Di madam no even mind me.

Di next ting di madam say make di husband enter, say e don see two facemask.

Di man enter and siddon with im wife for back seat.

Na im I look back to make sure say dem use dia facemask.

True true, dem wear facemask but di ting be say, dat time wey madam jump enter back seat, e quick quick remove im brazier and G-string dross.

Di madam cover im face withdi dross and give im husband di bra to wear as facemask. Case close!

Na so I carry dem dey go dia church for Dopemu. After all, facemask na facemask.

Make we jam again on Friday.

Tank you.

Tank you very much.

And tank you very, very much indeed.



Comments

Post Comment

Wednesday, September 24, 2025 4:02 PM
ADVERTISEMENT

Follow us on

GOCOP Accredited Member

GOCOP Accredited member
logo

NEWS EXPRESS is Nigeria’s leading online newspaper. Published by Africa’s international award-winning journalist, Mr. Isaac Umunna, NEWS EXPRESS is Nigeria’s first truly professional online daily newspaper. It is published from Lagos, Nigeria’s economic and media hub, and has a provision for occasional special print editions. Thanks to our vast network of sources and dedicated team of professional journalists and contributors spread across Nigeria and overseas, NEWS EXPRESS has become synonymous with newsbreaks and exclusive stories from around the world.

Contact

Adetoun Close, Off College Road, Ogba, Ikeja, Lagos State.
+234(0)8098020976, 07013416146, 08066020976
info@newsexpressngr.com

Find us on

Facebook
Twitter

Copyright NewsExpress Nigeria 2025