I give Sikiratu Red Card for Easter (2)

Posted by News Express | 9 April 2021 | 1,075 times

Gmail icon


I know say, I suppose to forgive Sikiratu as e be say we like oursef gan. But my broda, I no wan do anyting wey go disturb my business.

And di only business wey I get for dis world, na dis my taxi driver work.

If anyting make me no fit maintain my guonguoro again, na im be say my business don close be dat. And if my business kpafuka, wetin go happen to my wife Bose, and my two woman pikin dem – Bisi and Funke? Na im be say to peme sef better pass to siddon for house dey look my family anyanya from morning to morning everyday.

Sikiratu na better babe sha, I swear! Plenty times, e go tell me, “My darling Oga MAT, make we go rock town today. No worry about di expenses, make all dey for my head.”

And we go go out, Sikiratu go pay for everyting, plus including “short time”, if we use am. (But remember say we never do o!)

Wetin come make me vex with my Siki Babe be say, di girl come change before Easter gan. I no come understand Sikiratu again.

Dat Wednesday before Easter, as I go Madam Shine Buka make I take My Usual take cool down small and also see Sikiratu, as I wan go, I call Sikiratu, give am envelope.

Sikiratu open di envelope, bring out di 5k wey I dash am to take do Easter.

See as Sikiratu come frown im face one kind. E throw di envelope and 5k for my body. E say wetin e wan take 5k do? E say weda 5k fit buy Brazilian hair wey e wan buy and fix for salon dis Easter?

I ask am weda na im tell me to give am money. E say no.

I ask am weda im don tell me tele tele say e wan fix Brazilian or Australian or American or South African or even Naija hair before. E say no.

I ask am why e no first tank me for di 5k before e begin protest, and even throw di money for my body.

I ask am how much to buy and fix Brazilian hair go cost. E say 30k. And e say di hair go last for only one month. Tori Olorun!

I tell am say no troublem, say I go come give am di 30k di next day wey be Thursday, di day before Good Friday.

I carry di 5k, put am for my shokoto trouser. I pay for My Usual wey I don drink. I hold Sikiratu, kiss am for head and begin go my house.

Di buka girl no know say dat kiss na final kiss be dat. Na red card. And na dat day gan gan I block Sikiratu number for my torch light chinko phone.

I come talk am for my mind say, If I begin dey buy 30k Brazilian hair for Sikiratu every month, my own don finish for Lagos be dat nau.

Make we jam again on Tuesday.

Tank you

Tank you very much

And tank you very, very much indeed.


Source: News Express

Readers Comments

0 comment(s)

No comments yet. Be the first to post comment.


You may also like...